Job 22pcm

1Elifaz wey kom from Teman still sey:

2“E get any wise pesin wey God fit gain from?

3Yu feel sey God get gain from di good tins wey yu dey do or di rite way wey yu dey follow?

4God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am?

5No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do.

6Yu sey make yor broda pay di money wey e dey hold yu kon seize all en klot.

7Pipol wey don taya to work, yu nor agri give dem wota drink and wen dem dey hongry, yu nor give dem food chop.

8Yu dey opress pipol with yor pawa and pozishon.

9Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die.

10Naw, si as trobol surround yu and fear don dey kill yu small-small.

11Yu nor dey si again, bikos di trobol don too dark for yor eye and wota don kover yu.

12God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.

13But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’

14Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven?

15Yu really won waka for di road wey wiked pipol dey pass?

16Even before dia time end, wota don karry dem go.

17Dis na di pipol wey rijet God, dem bilive sey E nor fit do dem anytin.

18Na dis God make dem get money, yet I nor fit undastand how wiked pipol dey tink sef.

19Good pipol dey happy and doz wey dia belle klean, dey laf.

20Evritin wey wiked pipol get don skata and fire don burn di ones wey remain.

21Job! Abeg, go setol with God. Nor dey bihave like sey God na yor enemy. If yu follow am make peace, E go bless yu.

22Make yu follow di tins wey E dey tish kon keep en words for yor heart.

23Make yu go back go meet God; if yu remove wiked tins for yor house, E go karry yu up.

24If yu stop to porshu money kon trowey yor gold for river,

25God wey dey heaven go bi yor propaty. E go bi yor gold and silva.

26Den yu go bilive God kon know sey na-im dey give happiness.

27Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make.

28Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way.

29God dey save pipol wey dey honbol, but doz wey feel sey dem wise, E dey disgrace dem.

30God go save pesin wey nor dey innocent, bikos yor hand dey klean.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 22.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.