1Job ansa:
2“Make yu listin to wetin I dey tok. Dis na all di konfort wey I ask from yu.
3Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
4I dey komplain give human being? If I nor dey komplain give human being, wetin go make mi kwayet?
5Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu! Make yu shok put yor hand for mout.
6Wen I tink about wetin dey happen to mi, my body go dey shake, bikos of fear.
7“Why God dey let wiked pipol live? Why E dey make dem old kon prosper?
8Dem get shidren and grand-grand shidren and dem dey si as dia shidren dey grow.
9God nor dey send trobol go skata dia house; dem nor dey live with fear.
10All dia kattle dey get belle and born without trobol or wahala.
11Dia shidren dey run and play like animal pikin wey nor get problem.
12Dem dey dance, dey play sheke-sheke, harp and dey enjoy dia trumpet sound.
13Dem dey live dia life for peace and dey die without trobol.
14Dem dey tell God sey ‘Leave us! Wi nor won serve or follow Yu.’
15Dem sey ‘Who bi dis God sef? Why wi go serve am? Any gain dey to pray to am?’
16Dem tink sey na dia pawa dem take get evritin wey dem get, but I nor agri with wetin dem dey tink.
17“Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get? Wiked pipol don ever face trobol? God don ever vex ponish wiked pipol?
18How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey or dust wey breeze karry go?
19Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’ No! But make God ponish di pesin wey sin, so dat e go know wetin e do!
20Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.
21Bikos wen pesin die, e nor kare about wetin happen to en family.
22Anybody fit tish God, abi who dey judge doz wey dey heaven?
23“Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die; dem die with happiness and dem dey for peace.
24Dia body dey shine well-well and dia bones dey strong.
25Odas nor get happiness at-all; dem live and die with bitterness for dia mind.
26But evribody must die. Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.
27“Yes! I know wetin yu dey tink. Yu dey tink how yu go take wound mi
28Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
29Abi yu neva tok to pipol wey travel before? Yu nor know di kind ripot wey dem dey bring kom back?
30Di day wey God go vex ponish pipol, na di wiked ones E go sorry for.
31E nor get who fit blame wiked pipol for all wetin dem don do.
32Dem go guide di grave wey dem beri dem put afta dem don die.
33Pipol go many for dia burial and di san go kold for dia body.
34So how yor bad words won take konfort mi wey e bi sey evry ansa wey yu dey give mi, na lie!”