Job 20pcm

1Zofar still sey:

2“Job! Yu dey make mi vex. Naw, I nor fit wait before I ansa.

3All di tins wey yu dey tok since, na curse! But I know wetin to tell yu.

4Yu know sey wen God first kreate human being,

5wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.

6Dem fit big well-well, dey great and dia head dey tosh heaven,

7but God go blow all of dem trowey like dust. Pipol wey know dem before go sopraiz kon ask, ‘Where dem go?’

8Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.

9Pipol wey si dem before, nor go si dem again. Dia family nor go si dem again

10and dia shidren go beg poor pipol; dem go pay back all wetin dia papa tif from poor pipol hand.

11Dia smooth and betta body, go soon turn to dust.

12Bikos bad tins sweet, dem kon keep some for dia mout

13and bikos dem won enjoy di sweetness, dem nor gri komot am from dia mout.

14But di food go betta like poizin for dia belle. E go bi like snake poizin inside dia body.

15Wiked pipol go vomit di money wey dem tif. God go take am back with di ones wey dey dia belle.

16Wetin wiked pipol swallow bi like poizin; e dey kill dem like who wiked snake bite.

17Dem nor go live to si di river wey get olive or di one wey milk and honey full.

18Dem must die leave evritin wey dem work for; dem nor go get shance to chop from dia money,

19bikos dem don beat and kollect from pipol wey nor get. Dem still seize dia house,

20bikos nor-tin dey rish dem, but wetin dem get nor go fit save dem.

21Nor-tin dey remain for plate wey dem take chop; dat na why dia propaty nor dey last.

22Wen dia propaty don dey plenty, trobol go kom skata and distroy am.

23Make God feed dem beleful with trobol. Make God pour in vexnashon for dia head like evening rain dey fall.

24Wen dem won run, bikos of iron swod, di bronze bow go shot dem fall.

25As dem pul di arrow komot dia body, blood go rush kom out and fear go kill dem trowey.

26Evritin wey dem don save, go skata. Fire wey pesin nor lite, na-im go kom burn dem die with dia family.

27Heaven nor go kover dia sins and di eart go tok against dem.

28Evritin wey dem get, God go distroy am with wota wen E dey vex.

29Dis na wetin go happen to wiked pipol! Dis na wetin God go do dem.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 20.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.