1Job ansa:
2“Bildad, na wen yu go stop to ponish and worry mi with yor words?
3Yu don already curse mi rish ten times. Yu suppose to dey shame as yu dey trit mi like dis.
4Even if I do bad tin, how dat one take koncern yu?
5If yu feel sey yu betta pass mi kon dey use my trobol against mi,
6den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.
7“If I kry out bikos of dis trobol sef, nobody go ansa mi. I dey kry for help, but nobody dey hear am.
8God don block my way and I nor fit pass; E don hide my way for darkness.
9E don take all my glory kon distroy my respet.
10E skata mi for evry side, until I nor get hope again.
11God dey vex for mi, so E kount mi join en enemies.
12En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
13“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
14My family don go leave mi. My friends don forget mi.
15Even di strenjas for my house don forget mi and my wimen savant dey do like sey na mi bi strenja.
16Wen I koll my savant, e nor gri ansa, even wen I beg am with my own mout.
17My wife nor fit stay where I dey breath and my own broda nor gri kom near mi.
18Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
19My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.
20My bones just whole my skin and I just manage dey run with my life.
21Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand.
22Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi? Abi yu neva trobol mi rish?
23“I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok, make e for rite dem for book!
24Or make e karve and rite di words for stone, so dat dem go dey forever.
25But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end.
26Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.
27I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all.
28So wetin make yu dey akuiz mi dey sey, ‘Na yu kause di wahala wey yu dey face?’
29But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”