1Bildad wey kom from shuh kon sey:
2“Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.
3Wetin make yu dey feel sey wi nor get sense like animals?
4Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
5Wiked pipol lite go soon off; dia fire nor go ever burn again.
6Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
7Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
8Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.
9Trap go katch dia leg kon hold dem for der.
10Dem hide rope for dem for groun kon set trap for where dem go waka pass.
11Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
12Sofa dey hongry dem; wahala dey wait for dem to fall.
13Sickness don chop dia body finish and na dis make dia hands and legs dey rotin.
14Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
15Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?
16Dia rut don dry finish and dia branches go skata.
17Pipol nor go remember dem for dia house or for outside again, bikos dia name don fade komot from di land.
18Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.
19Dem nor get shidren, grand-shidren or pesin wey go live afta dem don die.
20From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,
21‘True-true, na so wiked pipol house dey bi and pipol wey nor know God, na dem dey stay dis kind place.’ ”