Job 17pcm

1“My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.

2Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi.

3God, make Yu show sey I dey innocent, bikos nobody gri bilive or fight for mi.

4Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi.

5Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am.

6Naw, God don make pipol dey laf mi; dem dey kom spit for my face.

7My eyes don swell-up bikos of kry; my body don tin like broom.

8Good pipol dey shok wen dem si mi. Doz wey dey innocent go tok against doz wey nor dey fear God.

9But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.

10“But if all of dem kom follow mi stand, I nor go even si one wey wise.

11My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again.

12But my friends don turn nite to day; dem sey lite don near, but na darkness I dey si.

13My only hope na where dead body dey, where I go for go sleep for darkness.

14If I sey, ‘Grave na my papa’ and di worm wey dey chop mi, ‘Na my mama and sistas,’

15any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?

16No, my hope go follow mi wen I dey go where dead body dey? Wi go-go grave togeda?”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 17.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.