Job 16pcm

1Job ansa:

2“I don hear many words like dis before. Yor konfort na more trobol for mi!

3All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu? Wetin make yu still dey ansa mi?

4If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu.

5But fit to sey na mi I for enkourage yu. I go try reduce yor pains.

6“But e nor get wetin I go tok give yu, wey fit help mi and even if I kwayet, e nor go remove my pains.

7My Oga God, true-true, Yu don kill my full family and Yu don make life taya mi.

8Yu don seize and turn mi to yor enemy. Na skin and bone I bi and pipol dey use am against mi.

9God don skata mi, bikos E dey vex. E tear mi with en tit and dey look mi one kind.

10Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.

11God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand.

12I dey live for peace before, but God don skata mi. E seize mi for my neck kon skata my life. E dey plan against mi.

13E dey shot mi with en arrow from difren direcshon. E nor sorry for mi wen E dey wound mi and na my blood wet di groun.

14E wound mi many times. E attack mi like soja wey hate pesin.

15I dey mourn with sak klot and I use san take kover my face.

16I kry sotey my eyes don dey red and swell-up and naw, na only darkness I dey si.

17I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin.

18“Dis groun, na beg I dey beg yu, make yu nor kover di bad tins wey dey happen to mi; nor kwayet naw wen I dey kry for help!

19I know sey pesin dey for heaven wey go stand fight for mi.

20My friends dey tok against mi and I dey kry give God.

21Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God, just as pesin dey beg en friend.

22My years nor plenty again and I go soon go where I nor go fit kom back again.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 16.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.