1Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
2“Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?
3No wise pesin go tok as yu dey tok so or sey en dey rite with en yeye words?
4Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?
5Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.
6E nor get any nid for mi to kondemn yu; bikos only yor words don kondemn yu.
7Na yu bi di first man wey dem born? Dem don born yu before God kreate di mountins?
8Yu dey hear di plans wey God dey make? Na only yu get human being sense?
9Wetin yu tink sey yu know wey wi nor know? Wetin yu feel sey yu undastand, wey wi nor undastand?
10Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
11God konfort too small for yu? Abi en gentol words nor rish for yu?
12Wetin make yu nor dey rizin well again? Wetin make yor eyes dey weak,
13sotey yu dey tok all dis kind words, bikos yu dey vex for God?
14Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?
15God nor even bilive en own angels, bikos dem nor klean rish for en eye,
16how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
17If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
18Pipol wey get sense don tish mi trut wey dem learn from dia papa;
19doz wey God give di land before any strenja kon stay with dem.
20Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
21Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
22Dem nor get hope to kom out from darkness, bikos swod dey wait to kill dem trowey.
23Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
24Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
25bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
26Dem hold dia strong swod dey won fight di Oga God.
27Dis wiked pipol big and dem dey prosper; dia waist fat well-well too.
28But dia towns go skata. Dem go stay for abandon house wey don near skata.
29Dia money nor go tey for dia hand and nor-tin wey dem get, go last. Even dia propaty go finish.
30Dem nor go fit run from darkness; dem go bi like tree wey en branches don burn finish and dem go skata as God breath.
31If dem nor get sense rish and dem kon dey bilive bad tins, na di bad tins go follow dem.
32Dem go die finish before dia time go rish den dia branches nor go ever green again for life.
33Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits; like olive tree wey lost en beauti.
34Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all and na fire go burn di house wey dem build with wayo money.
35Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”