1Job kon ansa:
2“Today, my komplain still dey make my heart betta; I nor fit hold my bitterness.
3If to sey I know where I go for si God and how to go where E dey,
4I for komplain gi-am kon tell am all di trobol wey I dey face.
5I won know wetin E go tok and how E go ansa mi.
6God go fight mi with all en pawa? No! I nor tink so. E go listin and ansa mi wen I tok.
7Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok, den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever.
8I don find am go east, but I nor si am. I nor si am for west wen I find am go der too.
9Wen God dey work for nort and sout, I nor still si am.
10Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold.
11Bikos I just dey waka follow God for back; for di road wey E choose by ensef and I nor dey waka on my own.
12I dey always do wetin E tok; dey follow en words; nor bi my own.
13E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.
14E go do wetin E don plan for mi. Na-im dey kontrol my destini.
15Na dis make mi dey fear and wen ever I si am, my hold body go dey shake.
16True-true, na God make mi dey fear. E don distroy di mind wey I get.
17Na God, nor bi di darkness make mi kwayet, even doh di darkness don kover my face.