Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Jeremiah 47

:
Nigerian - pcm
1 Before Egypt king attack Gaza, God tok to mi about Filistia sey,
2 “Look! Wota dey boil for nort and e go rush kom like river wey dey flow. Dem go kover di land plus evribody and evritin wey dey der. Pipol go dey shaut for help and evribody for di eart go kry well-well.
3 Wen dem hear dia enemies shariot sound, dia pawa go fail dem and papa and mama go run leave dia shidren.
4 Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. Mi wey bi God go distroy Filistia pipol and all di pipol wey kom from Krete wotaside.
5 Bitter wahala don kom meet Gaza pipol and Ashkelon pipol na wen una go stop to kry and pity for unasef?
6 Na wen una go kry rish kon sey, ‘Oga God, na wen Yu go stop to kill us with yor swod? Wi beg, make Yu put yor swod down kon rest small!’
7 But how di swod won take rest wen I don gi-am work to do? I don kommand am make e attack Ashkelon pipol and doz wey dey di wotaside.”