Jeremiah 46pcm

1God tok to mi about di nashons.

2Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.

3Egypt offisa dey shaut, “Make una ready una weapon kon mash go fight!

4Make una ready and klimb una horse! Make una take pozishon kon wear una helmet! Den sharp una spear kon wear una war klot!”

5But God ask, “Na wetin I dey si so? Dem dey turn back, bikos of fear. Babilon sojas win dia sojas and dem kon run. Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.

6Even di sojas wey sabi run well-well, nor fit eskape. Wen dem run rish di nort side for Eufrates River, dem stagga kon fall.

7Who bi dis wey dey flow kom like River Nile; like river wey en wota dey rush enter land?

8Na Egypt dey flow like River Nile; like river wey dey rush enter land. Egypt sey, ‘I go kover di world; I go distroy many towns and di pipol wey dey stay inside.

9Make una kommand di shariot make dem go! Make una send sojas from Ethiopia, Libya and Lydia. Men wey fit fight with shield and bow.’ ”

10Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.

11Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine, but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.

12Oda nashons don hear of una shame and evribody don hear una kry. One soja fall press anoda one and unasef don fall rish groun.

13Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,

14“Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’

15Wetin make una mighty god wey dem dey koll Apis, fall? Na God strike am.

16Una sojas don fall! Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi hurry go house go meet awa pipol, before awa enemies go kill us finish!’

17For der, dem go sey, ‘Make una give Egypt king new name, bikos e too make nois and na dis make am miss all en shance.’

18Mi, God wey dey mighty, I bi king. Na mi bi di God wey dey alive. As Mount Tabor high pass di mountins and Mount Karmel high pass di sea, di enemies wey dey kom attack una, na so dia pawa bi.

19Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves! Dem go turn Memfis to desert and e go bi dirty land where nobody dey stay.

20Egypt bi like fine melu, but sojas from nort go kom attack am like wiked fly wey dey bite pesin.

21Even di sojas wey dem hire lazy like small goat. Instead make dem stand fight, na run dem dey run. Di day for dem to face wahala and ponishment, don kom.

22Wen Egypt pipol si dia enemies dey kom, dem run kon dey hiss like snake. Dia enemies attack dem with axe like pesin wey dey kut tree

23or klear tick forest. Dia men too many to kount and dia sojas many pass ant.

24Dem disgrace Egypt pipol and na doz from nort win dem. Mi, wey bi God, don tok.”

25Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am

26give King Nebukadnezzar and en sojas wey won kill dem. But afta, pipol go stay for Egypt again, as dem do before. Mi, wey bi God, don tok.

27“So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.

28I go kom meet and save una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una. I go must ponish una, but I go do am to korrect una. Mi, wey bi God, don tok.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 46.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.