Jeremiah 2pcm

1God kon tell mi sey,

2“Go tell evribody for Jerusalem sey: ‘God sey, “I remember as una dey faithful wen una dey yong. Una bin love mi well-well like woman wey just marry; una follow mi waka for wildaness and for dry land.

3Dat time, Israel pipol dey holy to di Oga God; na dem bi di first fruit wey E plok and evribody wey won attack Israel, God dey ponish and distroy dem.” ’ ”

4Naw, Jakob shidren-shidren and Israel family, make una listin to God word.

5God sey, “Wetin una grand-grand papa dem sey I do wey make dem waka leave mi? Dem go woship yuzles juju and e kon make dem dey yuzles too.

6Dem nor even ask sey, ‘Where God wey take us komot from Egypt? Di Pesin wey take us pass wildaness and desert, land wey nor good and dey dry, where pipol nor dey stay or travel pass.’

7I take una go betta land, so dat una go enjoy di fruit and all di oda good tins wey dey der, but wen una rish der, una turn di land to dirty.

8Una priests nor even ask sey, ‘Where Oga God dey?’ Doz wey dey tish my law nor even know mi. Una rulers don turn from mi. Una profets dey profesai with Baal name and una leaders dey woship juju wey nor fit help or save dem.

9“Bikos of dis, mi God go tell una wetin I get against una and una shidren-shidren.

10Make una go shek thru Cyprus land for west or Kedar land for east, una go si sey dis kind tin neva happen before.

11No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.

12So heavens, make una sopraiz bikos of dis tins. Yes! Make una shok and sopraiz well-well,

13bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.

14“Israel pipol, dem nor born una as slave; na for war dem for katch and karry una go as slave.

15Di enemies dey shaut like lion as dem dey distroy my pipol; skata dia land and burn di towns with doz wey dey stay der.

16Yes! Memfis and Egypt sojas don distroy Israel glory and dem nor dey fear mi again.

17But na Israel pipol kause all dis tins, bikos dem leave di Oga wey bi dia God, even wen E dey show dem di korrect road.

18Wetin una go gain if una go back to Egypt go beg dem to kom help una? Wetin una tink sey una go gain, if una go Assyria go beg to drink wota from Eufrates River?

19Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.” Mi, wey bi God, don tok.

20“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.

21I bin plant una like special vine wey dem make with di best tins. So na how una kon take turn wiked vine, wey dey produce bad grape?

22No amount of soap wey una go take wosh una sin, go fit make una klean, bikos I still dey si all di wiked tins wey una dey do.” Mi, wey bi God, don tok.

23How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.

24Una bi like wiked woman donkey wey grow for desert and bikos e dey find man, e go dey use en nose smell evriwhere weda e go si any one. Nobody fit hold am if e nid to sleep with man. Man donkey nor nid to go find am, bikos na en dey run follow dem.

25Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”

26So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.

27Una wey sey na tree bi una papa and rock na una mama, God go disgrace una. Dis tins go happen, bikos instead of una to follow mi, una kon waka leave mi. But anytime una dey for trobol, una go sey make I kom save una.

28Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.

29So wetin make una dey komplain? All of una don sin against mi!” Mi, wey bi God, don tok.

30“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”

31Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’

32Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.

33Una really know how to run follow di pesin wey una love and bikos of dis, even ashawo, don learn join en work, bikos of wetin una dey do!

34Poor and innocent pipol blood don stain una klot, even doh una nor katch dem dey tif for una house. Yet, with all dis tins wey una don do,

35una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’

36Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.

37Una go kover una face with shame and sorrow wen una dey kom back from Egypt, bikos God don rijet di pipol wey una trust and even with dia help, e nor go still betta for una.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 2.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.