Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Jeremiah 1

:
Nigerian - pcm
1 Jeremaya wey bi Hilkaya pikin, na wetin e profesai, dey dis book. Jeremaya na one among di priests wey dey stay Anatot for Benjamin aria.
2 God first tok to Jeremaya for di thirtint year wen Amon pikin, Josaya dey rule Judah.
3 God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
4 God tell mi sey,
5 “Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”
6 So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”
7 But God sey, “Make yu nor sey, ‘I still yong.’ But yu go-go meet anybody wey I send yu go meet kon tell dem evritin wey I kommand yu.
8 Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”
9 So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
10 So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”
11 Afta, God koll and ask mi: “Jeremaya! Wetin yu dey si?” I ansa, “Na one almond tree branch.”
12 Den God sey, “Yu dey rite and dis mean sey, I dey look well to make sure sey evritin go happen, just as I tok am.”
13 God ask mi again, “Na wetin yu dey si?” I ansa, “I si pot wey wota full dey boil for di nort side and e dey kom meet us.”
14 So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.
15 All di sojas for nort, I go soon koll dem kom attack Jerusalem. Dia kings go build dia throne for Jerusalem gate kon distroy all di walls wey dey guide di town. Den dem go attack all di towns for Judah.
16 Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.
17 “But yu, Jeremaya! Make yu ready go tell dem evritin wey I kommand yu. Nor fear dem, if not, I go give yu betta rizin to fear dem.
18 Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
19 Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”