Isaiah 36pcm

1For di fourteent year wen Hezekaya bi king for Judah, King Sennakerib for Assyria kon attack and seize all Judah strong town.

2Den e kommand en offisa oga sey make e karry plenty sojas from Lakish go Jerusalem kon tell King Hezekaya sey make e surenda. So, di ofisas take-ova di road where di pipol for dey wosh and dry klot, near di Uppa Pool.

3Den, Eliakim wey Hilkaya born, Shebna wey bi di kourt seketry and Joah wey bi Asaf pikin wey dey keep rekord, kom out kon go meet Assyria offisa wey di king send kom.

4Di offisa tell Jerusalem pipol, “Make una tell Hezekaya sey, ‘Dis na wetin di great king for Assyria tok: “Wetin dey give yu dis mind?

5Yu tink sey ordinary word fit do wetin soja pawa fit do? Who una tink sey go help una fight Assyria pipol?

6Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”

7Di Assyria ofisas still sey, “May bi una go tell mi sey, ‘Wi trust di Oga awa God.’ But nor bi en Hezekaya curse? Hezekaya nor skata all en shrine and altars kon sey evribody for Judah and Jerusalem go woship for only one altar for Zion?

8I go make agriment with una bikos of di king. I go give una 2,000 horse, as long as una get who go ride dem.

9Una sojas nor even dey di same rank with Assyria soja wey small pass, even if una bring Egypt shariot and sojas kom help una.

10Na God kommand make mi kom here won distroy dis kountry so. Na God ensef tell mi sey, ‘Make yu go attack and distroy dis land.’ ”

11Den Eliakim, Shebna and Joah tell di offisa, “Make yu speak Aramaik give us. Wi dey undastand am, make yu nor speak Hibru, bikos all di pipol wey dey di wall dey listin.”

12Di offisa kon ansa, “Una tink sey na only di king and una three, di king send mi kom tell all dis tins? No! I still dey tell di pipol wey sidan for di wall, wey go soon chop dia shit kon drink dia piss, just as unasef go do.”

13Den di ofisas stand up kon shaut for Hibru, “Make una listin to wetin Assyria king won tell una.

14E dey warn una sey make una nor let Hezekaya deceive una, bikos Hezekaya nor go fit save una.

15Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town?

16“Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,

17till di king go put una for one kountry wey bi like una own; where vineyard dey wey go give una wine and flower to take make bread.

18“Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?

19Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?

20Wish time any kountry god don fit save en pipol from awa king? So, wetin make una tink sey una God go fit save Jerusalem?”

21Di pipol no tok at-all, bikos King Hezekaya don tell dem make dem kwayet.

22Den Eliakim, Shebna and Joah vex tear dia klot kon go tell di king wetin Assyria offisa tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 36.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.