Isaiah 35pcm

1Make di desert and doz dry aria, happy. Make di wildaness happy kon grow well like lily flower!

2Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.

3Di hands and legs wey don taya, make una make dem strong.

4Make una tell evribody wey nor get hope sey, “Make yu dey strong, nor fear at-all! God dey kom save yu and E go ponish yor enemies.”

5Den blind eyes go open and doz wey nor dey hear, go hear word.

6Pipol wey nor fit waka, go stand up dance and pipol wey nor fit tok, go dey shaut with happiness. River go dey flow kom from all di desert;

7di hot groun go turn to lake and wota go kover all di dry land. Where wiked dogs bin dey stay, grass, reeds and straw go grow full der.

8One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.

9No lion go dey der and wild animals nor go pass dat place. Na di pipol wey God don save, go pass dat road.

10Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 35.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.