1Pipol from evry nashon, make una kom! Make una gada kon listin. Make evribody for di world listin.
2God dey vex for all di nashons and dia sojas. E go kill and distroy dem.
3Nobody go beri dem; dem go rotin for groun. Dem go dey smell for evriwhere and dia blood go kover di mountins.
4All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose and di stars go fall like dry leaf wey fall from vine or fig tree.
5God dey ready with en swod for heaven and E go kut Edom; doz pipol wey E won kondemn and distroy.
6Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.
7God go kill dem with all dia animals. Blood go kover dia land and di pipol flesh go kover evriwhere.
8God don plan di day wey E go revensh Edom pipol for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.
9Edom rivers go turn black like shako and di land go turn to sulfur. Di whole kountry go black like shako too.
10E go dey burn both for day and nite and smoke go dey kom out from am forever. Nobody go ever fit stay or travel pass di land from one generashon go rish anoda.
11Na owls and ravens go dey stay di land. God nor go let am bear fruit again, just as e dey bear before wen God kreate di world.
12En kings and leaders nor go get anywhere to koll dia kingdom again and all en ofisas go disappear.
13Shuku-shuku go grow full dia farms; jackals and owls go dey stay for di town.
14Na for der doz animals for desert go dey do meetin; wiked goat go dey koll demsef for der and na der too doz wiked animals for nite, go dey kom rest.
15Wiked bird go build dia house, lay eggs, born dia shidren and kare for dem for der. Vulture go gada for der one-by-one.
16So make una take time take read God book! No one among dis animals go miss and all of dem go get dia patina. God don kommand and en ensef go bring dem togeda with en Spirit.
17Na God go divide di land give dem and E go give evribody di one wey rish am. Dem go stay for di land from one generashon go rish anoda one.