Isaiah 37pcm

1As King Hezekaya hear di ripot, e vex tear en klot kon wear sak klot go God temple.

2E send Eliakim wey bi di offisa wey dey kare for di palis, Shebna wey bi di kourt seketry and di senior priest go meet Profet Isaya wey bi Amos pikin and all of dem wear sak klot too.

3Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.

4Assyria king don send en offisa oga kon curse God. Make God wey bi yor God hear dis curse, so dat E go ponish di pipol wey curse am. So make una pray to God for all awa pipol wey remain.”

5Wen Profet Isaya si Hezekaya message wey e send thru en savants,

6e kon sey, “Make una tell di king: ‘Dis na wetin God tok: “Make una nor fear bikos of all di tins wey una hear and di curse wey Assyria king savant curse mi.

7Si, mi God go kontrol en mind; e go hear one news wey go make am run go back to en kountry, den I go kill-am for der.” ’ ”

8Wen Assyria offisa oga kom back from Jerusalem kon hear sey di king don komot from Lakish go fight against Libnah town wey near dem, e kon go meet and tok to am for der.

9Dem kon tell Assyria sojas sey, Egypt sojas wey King Tirhakah for Sudan dey lead, dey kom attack dem. As di king hear dis tin, e kon send leta go give King Hezekaya

10for Judah sey, “Di God wey yu dey trust don tell yu sey I nor go fit kill yu, but make yu nor let dat one deceive yu.

11Yu don hear wetin Assyria king dey do any kountry wey e won distroy. Yu tink sey yu fit eskape from am?

12Na my papa dem distroy Gozan, Haran and Rezef town and dem kill Eden pipol for Telassar and no god fit save dem.

13Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”

14Den, King Hezekaya kollect di leta from di messenja, read am kon take am go put for God altar for di temple,

15den e pray,

16“Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.

17Naw, my Oga God, make Yu hear and si wetin dey happen to us. Make Yu listin to all di tins wey King Sennakerib dey use take curse Yu wey bi God.

18“Oga God, all of us know sey, Assyria king don distroy plenty nashons kon skata dia lands;

19e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.

20Naw, Oga wey bi awa God, make Yu save us from Assyria pipol, so dat all di nashons for di world go know sey, na Yu bi God.”

21Den Profet Isaya send message go tell King Hezekaya about en prayer sey,

22“God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.

23“ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.

24Yu send yor savant kom boast give mi sey yu don defeat di highest mountins for Lebanon with all yor shariot. Yu dey boast sey yu dey kut di cedars tree wey tall pass and di cypress tree wey fine pass for der. Yu still sey yu don rish di place wey far pass for di forest

25kon dig well and drink betta wota for pipol land. Yu sey wons yor soja leg tosh River Nile, di wota go dry at wons.

26So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since? And naw, I don do am; bikos na mi give yu pawa to take skata all di towns wey dem protet.

27Doz wey dey stay der nor bin get pawa and fear dey katch dem. Dem bi like grass for field or grass wey dey grow on-top roof wey east wind go soon blow komot.

28I know evritin about yu; di tins wey yu dey do, di place wey yu dey go and how yu dey plan against mi.

29Di way yu dey karry body up and make mout, don rish my ear and naw, I go hook yor nose and yor mout kon take yu go back thru where yu pass kom.’ ”

30Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.

31Doz wey go survive for Judah, go grow like plant wey en rut deep well-well kon produce betta fruit.

32Pipol go survive for Jerusalem and Mount Zion, bikos God don sey dis tins must happen.

33So dis na wetin God tok about Assyria king: ‘E nor go enter dis town or shot one arrow against am. No soja wey karry shield go kom near di town and dem nor go build anytin take surround am.

34E go pass di same road wey e take kom go back and e nor go enter dis town. Mi, wey bi God, don tok.

35I go defend and protet dis town, bikos of my honor and wetin I promise David, my savant.’ ”

36So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!

37Den King Sennakerib for Assyria kon go back to Nineveh.

38One day wen e dey woship for Nisrok wey bi en god temple, Adrammelek and Shareza wey bi en sons kon shuk am die with dia swod, den dem run go Ararat land. En pikin Esarhaddon kon take-ova as king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 37.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.