Isaiah 20pcm

1God give dis message for di year wen King Sargon for Assyria send en kommander go fight and konker Ashdod.

2For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.

3Afta dem seize Ashdod town, God sey, “Isaya wey bi my savant naked dey waka about for three years naw. Dis na sign about wetin go happen for Egypt and Ethiopia.

4Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.

5Pipol wey trust Ethiopia and bilive sey Egypt go save dem, go fear and shame go katch dem.

6For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 20.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.