Isaiah 21pcm

1Dis message na about Babilon. Just as strong breeze dey blow kom from desert, Na so wahala go kom from one land wey pipol dey fear.

2I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”

3So bikos of all dis tins wey I hear, my belle kon dey pain mi and e dey make mi fear. E dey pain mi like woman wey won born.

4My heart dey shake and I dey fear well-well. Before, I dey like wen evening rish, but naw, I dey fear darkness.

5Dem don arrange di party tabol; put rug for groun where pipol wey dem invite go sidan put. But as dem dey chop and drink, dem kon hear di kommand, “Una wey bi sojas, make una prepare for war!”

6Den God tell mi, “Make yu go put pipol make dem dey guide, so dat dem go tell yu evritin wey dem si.

7Dem must shine dia eye to si wen men wey dey ride horse dey kom two-by-two and doz wey dey on-top donkeys and kamels.”

8Make di guide shaut, “Oga, I dey guide both for day and nite and na where yu sey make I dey, na der I dey”

9Si, men wey dey ride horse dey kom. Den di guide sey, “Babilon don fall! All di juju wey dem dey woship, skata for groun!”

10So my pipol Israel, wey dem mash for groun like flower, na di good news wey I hear from God wey dey lead heaven sojas, I don tell una so.

11Dis message na about Edom pipol. Somebody koll mi from Edom land sey, “Yu wey dey guide, na wen day go break? Na wetin remain for di nite? Make yu tell mi wen all dis tins go end.”

12So I ansa, “Morning dey kom, but nite go kom again. So if yu won ask again, wen dat time rish, make yu kom back kon ask.”

13Dis message na about Arabia pipol. Dedan pipol wey dey stay for karavan for di empty kountry for Arabia.

14Pipol wey wota dey hongry, make una give dem wota drink. Una wey bi Tema pipol, make una give doz strenjas food chop.

15Bikos dem dey run from swod, bow and all di bad weapons wey dem take dey fight war, bikos dem nor won die.

16And dis na wetin God wey get pawa dey tok, “Just one year from naw, all di pawa wey Kedar pipol tink sey dem get, go end.

17Kedar pipol wey dey fight with bow and arrow, na dem strong pass, but na only few of dem go remain. Mi wey bi Oga God for Israel don tok and na so e must mi.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 21.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.