1Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.
2God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time, broda go fight against broda and neighbour go fight against neighbour. Town go fight against town and kingdom go fight against kingdom.
3I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.
4I go give Egypt pipol to one bad ruler and na wiked kings go rule dem. Mi wey bi God wey dey lead heaven sojas, don tok.”
5River Nile go dry and all di oda river for Egypt go dry finish.
6Di place where di river dey flow from go dey smell and all di rivers go dry.
7All di plants wey dey float on-top di river, go dry; evritin wey dem plant near River Nile go die and breeze go blow dem trowey.
8Fishermen go kry well-well. Yes! Pipol wey dey katch fish der and doz wey dey trow net for di river, go dey kry with pain.
9Pipol wey dey make linen klot, go konfuse well-well and dem nor go know wetin to do.
10Pipol wey dey weave and doz wey dem hire to work, go taya and weak well-well.
11Zoan leaders na fools! Wise men for Egypt dey give di king yeye advise, if not, wetin go make yu tell Fero sey, “I dey among doz wey sabi rite and wi dey plan to ova-trow yu?”
12And naw, where doz wise men wey dey advise di king? Make dem kon tok evritin wey God dey plan to do for Egypt na!
13Zoan and Memfis leaders na fools. Na dem suppose lead di nashon, but bikos dem nor know di rite way, dem dey lead di pipol anyhow.
14God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do, nor dey rite at-all and naw, di pipol dey stagga like drunkard man wey sleep on-top en vomit.
15So, work or any betta tin nor go dey Egypt again; weda na for di leader or di ordinary pipol or di rish and di poor.
16For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.
17Den Judah pipol go sofa Egypt pipol and anybody wey go hear Judah pipol story, go dey fear, bikos of wetin God wey dey lead heaven sojas won do dem.
18For dat time, five towns for Egypt go dey speak Kanaan language kon promise to serve God. Dem go koll one of di town, “Sun town.”
19For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary.
20E go dey remind pipol for Egypt about God. Wen dem dey opress di pipol and dem koll God make E kom help dem, E go send pesin go diliver and help dem.
21God go show ensef to Egypt pipol; dem go woship am with ofrin and sakrifice kon know am well-well. Dem go promise God and do wetin dem promise.
22Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.
23Wen dat time rish, betta road go dey between Assyria and Egypt. Pipol for di two kountry go dey travel go visit each oda and di two nashon go woship togeda.
24Wen dat time rish, Israel pipol go bi di same with Egypt and Assyria pipol and dis three nashon go bi blessing to di whole world.
25God wey get pawa go bless dem kon sey, “Egypt wey bi my pipol, I go bless una. Assyria pipol wey I kreate and Israel pipol wey I don choose, I go bless una well-well too.”