Hosea 6pcm

1Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.

2Afta two or three days, E go heal us, so dat wi go fit stay for en present again.

3So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.

4But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.

5Na dis make mi send my profet kom give una di judgement and distroshon message. Just as day dey break for morning, na so too, my judgement go kom meet una.

6Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.

7But just like Adam, my pipol sef break di kovenant wey I make with dem.

8Na wiked pipol full Jabesh-Gilead town and na pipol blood kover all dia street.

9Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!

10I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.

11As for una Judah pipol, I don set time wen I go take ponish una bikos of una sins, even doh sey I go make my pipol prosper again.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Hosea 6.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.