Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Hosea 7

:
Nigerian - pcm
1 “Wen ever I sey I won heal and make my pipol, Israel prosper again, dia wikedness and di bad-bad tins wey dem dey do, nor dey allow mi do am. Samaria pipol dey shit each oda and dey do bad tins. Dem dey break enter pipol house and dey tif waka for street.
2 Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.
3 Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
4 All of dem dey sleep with who dem nor marry. Dia body dey hot like oven wey dem won take bake bread, bikos of di bad tins wey dem won do.
5 Wen di king dey do party, en and en ofisas dey drink well-well and dem go dey make plans with yeye pipol.
6 Yes, dia plan dey burn like hot oven. Dia vexnashon dey hot well-well for nite and wen dey break, e go rush kom out like fire.
7 All of dem dey burn well-well like oven; dey kill dia rulers one-by-one and yet, dem nor gri kom meet mi make I for help dem.”
8 God sey, “Efraim pipol bi like bread wey nor don. Dem don join and put hope for di towns wey dey round dem
9 and dem nor know sey na dis trust wey dem get for strenjas, distroy dia pawa. And naw, wahala dey kom, but dem nor know.
10 Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.
11 Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!
12 But as dem dey waka up-and-down, I go trow net wey go katch dem like bird. I go ponish dem for di evil tins wey dem don do.
13 Dia own don finish! Dem don forget mi kon dey do wetin I sey make dem nor do, so I go distroy dem. I won save dem before, but dem nor dey woship mi from dia heart.
14 Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
15 Even doh sey na mi train and make dem strong, dem still plan against mi.
16 Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”