Hosea 5
1 “Una wey bi priest, make una listin! Israel pipol, make una listin well-well! Una wey kom from royal family, make una listin well-well too bikos I dey kom judge una. Una lead di pipol enter trap bikos all of una dey woship juju for Mizpa and for Mount Tabor.
2 Una don dig one deep pit for where una dey woship juju, so I go ponish all of una.
3 I know Israel pipol well-well; di wiked tins wey dem do, nor go fit hide from mi. Dem don turn ashawo kon make demsef dirty.
4 “Dia wikedness nor allow dem turn kom meet mi wey bi dia God, bikos di juju wey dem dey serve, dey shark dem and dem nor won know mi at-all.
5 Israel pipol sturbones dey tok against dem. Dia sin dey make dem kick stone fall and Judah pipol dey fall with dem too.
6 Even wen dem kom sakrifice animals give God make E for favor dem, dem nor si am bikos E don turn from dem.
7 Dem nor dey faithful to God and dem born shidren wey nor know dia papa. So naw, di new moon festival go distroy dem and dia land.
8 “Make una blow di war trumpet for Gibeah! Make una blow di wiso for Rama! Make una blow di trumpet for Bet-Aven! Benjamin pipol make una shake with fear!
9 Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!
10 “God sey, “Judah leaders bi like pipol wey dey kut pipol land take. So I go pour my vexnashon like heavy rain for dia body.
11 Dem go opress and judge Israel pipol anyhow, bikos dem don make up dia mind to serve juju.
12 I go distroy Israel kon turn Judah land to where dem dey trowey dirty put.
13 Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.
14 I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.
15 I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”