Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Hosea 4

:
Nigerian - pcm
1 Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey: “For dis land, nobody love mi, dey faithful or si mi as en God.
2 Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.
3 So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”
4 God sey, “Make nobody akuiz or blame di pipol, bikos na una wey bi priests, I dey tok against.
5 Una go fall for day time and una wayo profets go fall with una for nite, den I go distroy una mama Israel.
6 My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
7 As di priests dey plenty, na so dia sin against mi, dey plenty too. So I go turn dia honor to disgrace.
8 Bikos dem dey make money from my pipol sin, dem kon dey kommit more sin.
9 Dem go sofa di same ponishment with di pipol! I go ponish and make dem pay for di evil and wiked tin wey dem do.
10 Even wen dem chop food, dem nor go beleful; dem go dey sleep with each oda, but dem nor go born pikin, bikos dem don turn from di Oga God kon dey follow oda gods.”
11 God sey, “Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem nor get sense again.
12 Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.
13 Dem dey offa sakrifice on-top mountin kon burn incense for di hills and under evry tall tree, bikos dem dey enjoy di shade! Bikos of dis, una dotas dey do ashawo and una dota in-law dey sleep with oda pipol husband.
14 I nor go ponish una dotas wen dem dey do ashawo or una dota in-law wen dem dey sleep with anoda pesin husband, bikos di men for di temple dey make sakrifice and sleep with ashawo too. So, pipol wey nor get sense, na distroshon go end dia life.
15 But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi, make una, Judah pipol nor bihave like dem. Make una nor go woship for Gilgal or Bethel or use God name take make promise for der.
16 Just as melu sturbon, na so Israel pipol bi. So, how I go fit take feed dem like lamb wey dey for open field?
17 Bikos of di juju wey Efraim pipol dey serve, curse dey dia head. So make una nor go near dem!
18 Afta dem don drink plenty wine, dem go-go sleep with ashawo; bikos dem like disgrace pass honor.
19 So, breeze go karry dem go and dem go shame sey dem dey offa sakrifice give juju.”