Hosea 3pcm

1God tell mi, “Make yu go love yor wife again, even doh e love anoda man and dey sleep with difren pipol. Na so too God love Israel pipol, even doh dem turn kon dey serve oda gods and dey give dia rice as ofrin to juju.”

2So I pay fifteen silva koin and seven basket for barley to take bring di woman back.

3Den I tell am, “Yu must always dey with mi and nor do ashawo or go sleep with anoda man again and mi mysef go dey with yu.”

4Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.

5But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Hosea 3.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.