1Den make yu go koll yor brodas, “Ammi” (wey mean “My pipol”)! And yor sistas, “Ruhamah” (wey mean “Pity”)!
2Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again.
3If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.
4I nor go pity or sorry for en shidren, bikos na ashawo wey nor get shame, born dem.
5Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.”
6But I go fence and block una mama with shuku-shuku, so dat e nor go waka go anywhere.
7E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”
8But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.
9So for harvest time, I go take all my gifts wey bi korn, wine, wool and linen wey I gi-am make e wear.
10I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa.
11I go stop all di party and feast wey e dey do evry mont, year and for Sabat Day.
12I go distroy all en vine and di fig tree wey e sey en lovers gi-am, bikos e dey serve dem. I go turn en gardins to wildaness; den wiked animals go distroy dem.
13I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.
14I go karry am go wildaness kon make am turn kom meet mi with di sweet-sweet words wey I go tell am.
15I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.
16For dat time, na husband yu go dey koll mi instead of yor masta.
17I go remove Baal name from yor mout and yu nor go ever take about am again.
18For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.
19Israel, I go make yu my wife; I go love and dey faithful to yu; I go always sorry for yu and yu go bi my own forever.
20I go keep my promise kon make yu my own, den yu go know sey na mi bi yor God.
21For dat time, wen my pipol Israel pray to mi, I go ansa dem.
22I go make rain fall and korn, grape and olive fruit go grow for di land.
23I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”