Amos 1
1 Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel.
2 Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”
3 God sey, “Damaskus pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem flog Gilead pipol with stik wey get iron tit.
4 I go send fire kon burn di palis wey King Hazael build. I go burn King Ben-Hadad strong-strong buildings rish groun.
5 I go skata Damaskus town gate; I go remove di ruler from Aven Valley kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden. Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.” Dis na wetin God tok.
6 God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.
7 So I go skata Gaza town with fire kon burn all di strong-strong buildings wey dem hide put.
8 I go kill all di rulers for Ashdod and Ashkelon town. I go ponish Ekron town and Filistia pipol wey remain, go die.” Oga God wey get pawa don tok.
9 God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.
10 So, I go skata di town kon burn all dia strong-strong building for der.”
11 God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.
12 So, I go distroy Teman town kon burn Bozrah strong-strong buildings.”
13 God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.
14 So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.
15 Dem go karry dia king and en ofisas as slave go anoda land.” Dis na wetin Oga God tok.