Amos 2
1 Dis na wetin Oga God tok, “Moab pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem nor respet Edom kings wey don die since; instead dem burn dia bones to ashes.
2 So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.
3 I go kill all dia rulers and leaders.” Dis na wetin Oga God tok.
4 God sey, “Bikos Judah pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem hate wetin I tish dem and nor gri obey my kommand. Di same lie-lie gods wey dia grand-grand papa dem serve, don deceive dem too.
5 So I go distroy Judah kon burn all di strong-strong buildings wey dey Jerusalem rish groun.”
6 God sey, “Bikos Israel pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem sell innocent pipol bikos of silva kon sell poor pipol, bikos of ordinary shoe.
7 Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy.
8 For where dem for dey woship, dem dey kover diasef with klot wey dem kollect from poor pipol as payment for debts. For inside God temple, dem dey drink wine wey dem kollect from doz wey dey whole dem money.
9 I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.
10 Na mi still bring una kom out from Egypt; lead una pass desert for forty years, den give una Amor pipol land.
11 I make some of una pikin profets and some of una yong men, I make dem Nazirites. So God kon ask dem, ‘Israel pipol, nor bi trut I dey tok?’
12 But una make di Nazirite drink wine kon sey make di profets nor prish my message.
13 But naw, I go distroy una finish and una go kry with pain like truck wey dem ova-load with korn.
14 Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.
15 Men wey dey karry bow nor go fit defend demsef; doz wey dey run fast nor go fit eskape and men wey dey on-top horse nor go fit save demsef.
16 For dat day, even di sojas wey strong well-well go drop all di tins wey e take dey fight kon run.” Na so Oga God tok.