Joel 3pcm

1“For dat time, wen I don make Judah and Jerusalem prosper again,

2I go gada and judge di pipol for Jehoshafat Valley, bikos of wetin dem do my pipol. Dem skata Israel pipol for evriwhere kon divide dia land.

3Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.

4Tyre, Sidon and Filistia pipol, wetin una dey do mi? Una dey try to pay mi back for wetin I do? If na so, den I go kwik-kwik attack una!

5Una take my gold and silva kon karry all my betta-betta tins go una temple.

6Una sell Judah and Jerusalem pipol give Greek pipol so dat dem go karry dem go far kountry.

7But I go bring dem kom back from where una sell dem go. Na wetin una do dem, na-im I go do una too.

8I go make dem sell una shidren give Judah pipol; dem go sell dem go Sabeans land wey far well-well. Mi, wey bi God, don tok.”

9So make una tell pipol for difren kountry sey: “Make una ready for war and koll all una strong-strong men, den gada dem go fight!

10Make una do una swod well kon sharpen una spears. Even pipol wey weak or nor get pawa, must fight.

11All di nashons wey dey round una, make dem join una as una gada for di valley.” So, my Oga God, make Yu send yor sojas kom!

12Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley. Na for der mi wey bi God go sidan judge all of dem.

13Dem wiked well-well and just as dem dey kut korn for harvest time, na so too I go kut dem trowey kon mash dem, just as dem dey mash grapes until di wine kom out finish.

14Plenty-plenty pipol dey Judgement Valley. For der, God day go soon kom.

15Di sun and moon don dark and di stars nor dey shine again.

16God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.

17“Den, Israel pipol, una go know sey na mi bi di Oga una God. I dey stay for Zion wey bi my holy hill. Jerusalem go bi holy town and strenjas nor go fit win am again.

18For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.

19But Egypt land go bi desert and na only dirty go dey Edom land, bikos dem attack Judah kon kill innocent pipol.

20But pipol go full Judah land forever and Jerusalem land go dey from one generashon go rish anoda one.

21My pipol wey I neva forgive before, I go forgive dem and mi wey bi Oga God go stay for Jerusalem with my pipol.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Joel 3.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.