1For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.
2En and en men dey der for two years and dat na di elevent year wen King Zedekaya dey rule.
3For di ninet day for di fourt mont for di same year wen honga for di town don strong well-well and all dia food don finish,
4di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.
5But Babilon sojas porshu di king, katch am for Jeriko field and all en sojas run leave am.
6Dem katch di king kon karry am go meet King Nebukadnezzar for Riblah, where e for judge en matter.
7Dem kill all Zedekaya sons for Zedekaya present. So Babilon king sey make dem pul Zedekaya eyes komot kon shain am with bronze shain, den karry am go Babilon.
8For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.
9E burn God Temple, di royal palis and all di house for Jerusalem.
10Babilon sojas wey kom with di soja oga kon distroy all di wall for Jerusalem.
11Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.
12But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.
13Babilon sojas break di two bronze pila wey dey God Temple, plus di stand wey dem dey move and di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” Dem karry di bronze dem go Babilon.
14Dem still karry di pots, shovels, trimmin shear, pans and all di tins wey dem make with bronze wey di priest dey use.
15Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.
16Di bronze tins wey King Solomon make for God Temple, plus di two pila, di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea,” di twelf bronze bull under “Di Sea” and di stand wey dem dey move, dey too heavy to karry.
17Each of di pilas high rish twenty-seven fit. Di bronze top for one pila high rish four and half fit and dem dekorate di bronze with pomegranate fruit. Na so too dem dekorate di sekond pila.
18Nebuzaradan katch Priest Seraya, Zefanaya di sekond priest and di three pipol wey dey guide di gate, den e karry dem go as prisonas.
19From di town, e still take one among di sojas offisa, five pipol from di king adviser wey dem si for di town, one seketry among di sojas wey dey train pipol as sojas and sixty pipol from di land wey dem seize.
20Nebuzaradan karry dem go meet King Nebukadnezzar for Riblah.
21King Nebukadnezzar sey make dem kill all of dem for Riblah wey dey near Hamat. Na so dem take karry Judah pipol komot from dia land.
22Naw, King Nebukadnezzar for Babilon kon make Gedalaya wey bi Ahikam pikin and Shafan grand-pikin, govnor ova Judah pipol wey dey en land.
23All di offisa for Judah sojas and dia men hear sey Babilon king don make Gedalaya govnor for Judah. So dem kon go meet Gedalaya for Mizpa. Di ofisas wey kom na, Netanaya pikin, Ishmael; Kareah pikin, Johanan; Tanhumet pikin, Seraya and Maakat pikin, Jaazanaya.
24Gedalaya kon promise sey e go save dem and dia men. E sey, “Make una nor fear to work with Babilon sojas. Make una stay for di land kon surenda to King Nebukadnezzar, den evritin go dey well.”
25But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
26Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.
27For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.
28E sorry and trit King Jehoiashin well kon gi-am house wey betta pass where all di oda kings for Babilon dey stay.
29E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol,
30so King Evil-Merodak dey give Jehoiashin evritin wey e wont until Jehoiashin die.