2 Kings 24pcm

1Wen Jehoiakim dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack dem. Jehoiakim obey King Nebukadnezzar for three years, den e kon won fight against am.

2God kon send Babilon, Siria, Moab and Ammon sojas against am; God send dem go distroy Judah, as E bin warn dem thru en profets.

3Just as God don tok before, E rijet Judah and en pipol, bikos of all di sins wey Manasseh kommit.

4Manasseh kill pipol wey nor do anytin and dia blood don stain Jerusalem, so God nor gri forgive dem.

5Di remainin tins wey Jehoiakim do plus evritin wey e get, dem rite am put for Judah kings history book.

6E die and en pikin, Jehoiashin kon take-ova as king.

7Egypt king with en men nor komot from dia land again go fight, bikos Babilon king don konker evriwhere wey Egypt king bin get before from Egypt wotaside go rish Eufrates River.

8Jehoiashin na eighteen year wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama na Nehushta and na Elnatan wey kom from Jerusalem, born am.

9E nor gri obey God, just like en grand-grand papa dem.

10For dat time, di offisa oga for King Nebukadnezzar for Babilon kon go fight and seize Jerusalem.

11King Nebukadnezzar for Babilon kom di town wey en offisa seize.

12King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.

13All di good and betta tins wey dey di royal palis and di temple, King Nebukadnezzar pak all of dem. All di gold tins wey King Solomon for Israel make put for God Temple, King Nebukadnezzar remove all of dem, just as God tok.

14King Nebukadnezzar karry evribody komot from Jerusalem, plus di ofisas and sojas (all di pipol, na 10,000). Plus all di men wey get skill and doz wey dey work with iron. E nor leave anybody esept di poor pipol wey dey di land.

15E karry King Jehoiashin from Jerusalem go Babilon, with di king mama, en wifes, priests and all di top ofisas for di land.

16King Nebukadnezzar karry all di sojas 7,000, plus 1,000 men wey dey work. All doz wey get heart and sabi fight dey join dem too.

17King Nebukadnezzar kon make Jehoiashin papa broda, Matanaya king for Jehoiashin place. E shange Matanaya name to Zedekaya.

18Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey kom form Libnah, born am.

19E nor gri obey God, just as Jehoiakim bin do.

20So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Kings 24.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.