1 Chronicles 1pcm

1Na Adam born Seth, Seth born Enosh, Enosh born Kenan

2and na Kenan born Mahalalel. Na Mahalalel bi Jared papa.

3Jared born Enoch, Enoch born Metuselah, Metuselah kon born Lamek.

4Lamek born Noah, Noah born Shem, Shem born Ham and na Ham born Jafet.

5Jafet shidren na: Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.

6Gomer shidren na: Ashkenaz, Difat and Togarmah.

7Javan shidren na: Elisha, Tarshish, Kittite and Rodan.

8Ham shidren na: Kush, Mizraim, Put and Kanaan.

9Kush shidren na: Seba, Havilah, Sabteka, Rama and Sabtah. Rama shidren na: Sheba and Dedan.

10Na Kush born Nimrod and Nimrod kon bi di first pesin wey strong well-well for di world.

11Na Mizraim born Lud, Anam, Lehab, Naftuh,

12Patrus, Kasluh, Krete (wey Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol too.

13Na Kanaan bi Sidon and Het papa, but na Sidon bi en first pikin.

14Na Kanaan still born Jebus, Amor, Girgash,

15Hiv, Ark, Sin,

16Arvad, Zemar and Hamat pipol.

17Shem shidren na: Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Aram. Aram shidren-shidren na: Uz, Hul, Geta and Meshak.

18Na Arfaxad born Shelah and na Shelah bi Eber papa.

19Eber born two pikin: one name na Peleg (wey mean divide), bikos e born am for di time wen God take divide and make pipol dey speak difren language for di world. Di oda pikin name na Joktan.

20Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,

21Hadoram, Uzal, Diklah,

22Ebal, Abimael, Sheba,

23Ofir, Havilah and Jobab pipol.

24Na Shem and Abram family pipol bi dis: Shem, Arfaxad, Shelah,

25Eber, Peleg, Reu,

26Serug, Nahor, Terah

27and Abram wey God shange en name to Abraham.

28Abraham born two sons: Isaak and Ishmael.

29Dis na dia shidren-shidren: Na Nebaiot bi Ishmael first pikin, before e kon born Kedar, Adbeel, Mibsam,

30Mishma, Dumah, Massa, Hadad, Tema,

31Jetur, Nafish and Kedemah. Na Ishmael shidren dem bi.

32Keturah wey bi Abraham girl-friend, na-im born Zimran, Jokshan, Medan, Midian, Ishbak and Shuah. Na Jokshan born Sheba and Dedan.

33Midian shidren na Efah, Efer, Hanok, Abidan and Eldaah. All dis pipol na Keturah sons.

34Na Abraham bi Isaak papa. Isaak shidren na: Esau and Jakob (wey God shange en name to Israel).

35Esau shidren na: Elifaz, Reuel, Jeush, Jalam and Korah.

36Elifaz shidren na: Teman, Omar, Zefi, Gatam, Kenaz, but Timna still born Amalek for am.

37Reuel shidren na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah.

38Seir shidren na: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, Dishon, Ezer and Dishan.

39Lotan shidren na: Hori and Homam (and Timna, na Lotan sista).

40Shobal shidren na: Alvan, Manahat, Ebal, Shefi and Onam. Zibeon shidren na: Aiaya and Anah.

41Anah son na Dishon. Na Dishon born Hamran, Eshban, Itran and Keran.

42Ezer shidren na: Bilhan, Zaavan, Jaakan. Na Dishan born Uz and Aran.

43Na di kings wey rule Edom land before any king rule Israel pipol bi dis. Bela wey Beor born and e kom from Dinhabah.

44Wen Bela die, Jobab wey bi Zera pikin wey kom from Bozrah kon take-ova as king.

45Wen Jobad die, Husham wey kom from Teman land kon take-ova as king.

46Wen Husham die, Hadad wey Bedad born kon take-ova as king and e rule from Avit town. E win Midian pipol for war for Moab.

47Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon take-ova as king.

48Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon take-ova as king.

49Wen Shaul die, Baal-Hanan wey Akbor born kon take-ova as king.

50Wen Baal-Hanan die, Hadad wey kom from Pau kon take-ova as king. En wife name na Mehetabel, wey bi Matred pikin and na Me-Zahab bi Matred mama.

51Hadad kon die. Di shief for Edom tribe na: Timna, Alvah, Jetet,

52Oholibama, Elah, Pinon,

53Kenaz, Teman and Mibzar,

54Magdiel and Iram. All dis na dis na Edom shiefs.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.