1Israel sons na: Reuben, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Zebulun,
2Dan, Josef, Benjamin, Naftali Gad and Asher.
3Judah sons na: Er, Onan and Shelah. Na one Kanaan woman wey en name na Batshua, born dis three shidren for Judah. Er wey bi Judah first pikin kon make God vex and God kill-am.
4Tamar wey bi Judah pikin wife, born Perez and Zera give Judah and all en sons kon bi five.
5Perez sons na: Hezron and Hamul.
6Zera sons na: Zimri, Etan, Heman, Kalkol and Dara.
7Karmi sons na: Akan wey bring wahala kom Israel wen e tif wetin dem dedikate give God.
8Na Etan born Zabud.
9Di sons wey dem born give Hezron na: Jerahmeel, Ram and Kaleb.
10Na Ram bi Amminadab papa and Amminadab born Nahshon wey bi shief for Judah tribe.
11Nahshon born Salma and na Salma born Boaz.
12Boaz na Oded papa and na Obed born Jesse.
13Eliab na Jesse first pikin, why Abinadab na di sekond born, follow by Shimea,
14before Netanel, Raddai,
15Ozem and David.
16Dia sistas na Zeruaya and Abigail. Zeruaya three sons na: Abishai, Joab and Asahel.
17Abigail born Amasa wey en papa kom from Ishmael tribe.
18Kaleb wey bi Hezron pikin marry Azuba wey dem still dey koll Jeriot. En sons na: Jesher, Shobab and Ardon.
19Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am.
20Na Hur bi Uri papa and na Uri born Bezalel.
21Wen Hezron don rish sixty years, e kon marry Gilead sista wey Makir bi dia papa and e born Segub for am.
22Na Segub bi Jair papa, wey get twenty three towns for Ramot land.
23But Geshur and Aram win Jair, Kenat and sixty towns for der. All dis shidren na Makir wey bi Gilead papa grand-grand shidren.
24Afta Hezron don die, Kaleb kon sleep with Efrat wey bi en papa wife and e born Ashhur wey bi Tekoa papa.
25Jerahmeel wey bi Hezron first son, en shidren na: Ram, Bunah, Oren, Ozem and Ahijah.
26Jerahmeel get anoda wife wey dem dey koll Atarah and na en bi Onam mama.
27Ram wey bi Jerahmeel first son, en shidren na: Maaz, Jamin and Eker.
28Onam sons na: Shammai and Jada. Shammai sons na Nadab and Abishur.
29Na Abihail bi Abishur wife and e born Ahban and Molid for am.
30Nadab sons na: Seled and Appaim. Seled nor born boy pikin before e die.
31Appaim son na: Ishi and Ishi born Sheshan, while Sheshan born Ahlai.
32Jeda wey bi Shammai broda, en sons na: Jeta and Jonatan. Jeter nor born boy pikin before e die.
33Jonatan sons na: Pelet and Zaza. Na Jerahmeel shidren-shidren dem bi.
34Sheshan born only girls. Sheshan get one Egypt pesin wey bi en savant and en name na Jarha.
35Sheshan give en girl pikin to en savant as wife and e kon born Attai for am.
36Na Attai bi Natan papa, while Natan kon bi Zabad papa.
37Na Zabad bi Eflal papa, while Eflal born Obed.
38Obed na Jehu papa and Jehu na Zabud papa.
39Na Zabud bi Helez papa and Helez na Eleasah papa.
40Eleasah born Sismai and na Sismai bi Shallum papa.
41Jekamaya wey born Elishama, na Shallum bi en papa.
42Kaleb wey bi Jerahmeel broda, en sons na: Mesha wey bi Zif papa and en sekond pikin na Maresha wey bi Hebron papa.
43Hebron sons na: Korah, Tappuah, Rekem and Shema.
44Shema na Raham and Jorkeam papa. Rekem na Shammai papa.
45Shammai son na Maon wey bi Bet-Zur.
46Kaleb girl-friend wey dem dey koll Efah kon born Haran, Moza and Gazez. Na Haran bi Gazez papa.
47Jahdai sons na: Regem, Jotam, Geshan, Pelet, Efah and Shaaf.
48Kaleb girl-friend wey bi Maaka born Sheba and Tirhana.
49Na Maaka still born Shaaf wey bi Madmanna, Sheva, Makbena and Gibea papa. Kaleb girl pikin na, Aksah.
50All dis na Kaleb shidren-shidren. Hur wey bi Efrat first pikin, na en sons bi dis: Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa;
51Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.
52Shobal wey bi Kiriat-Jearim papa, en sons na: Haroeh and half of Manahat pipol.
53Kiriat-Jearim family na: Itrite, Put, Shumat and Mishra pipol. Pipol for Zorat and Eshtaol kom from dis group.
54Salma sons na: Betlehem, Netofat, Atrot Bet-Joab, half of Manahat and Zor pipol,
55while di skribe pipol wey dey stay for Jabez na: Tirat, Shimeat and Sukat. Dis na Ken pipol wey kom from Hamat, wey bi Rekab papa.