1 Chronicles 9pcm

1Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.

2Doz wey first kom back to dia land na: di priests, Levi pipol, doz wey dey work for di temple and some few Israel pipol.

3Some of di pipol wey kom back to Jerusalem na from Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes.

4Utai family dey among di ones wey kom back to Jerusalem. Utai na Ammihud pikin and na Omri bi en grand-papa. Na Imri wey Bani born, bi Omri papa and na Perez wey Judah born bi Bani papa.

5Odas still kom back from Shilon family and dem bi Asaya wey bi di first-born and en sons.

6From Zera family, Jeuel and en family kom back too. Na 690 family for Judah kom back to Jerusalem.

7Doz wey kom back from Benjamin tribe na: Sallu wey Meshullam born. Meshullam na Hodevah pikin and na Hassenuah bi Hodevah papa.

8Ibneaya wey Jeroham born naim bi Hassenuah papa. Jeroham papa na Elah wey Uzzi born and na Mikri bi en grand-papa. Meshullam wey bi Shefataya pikin, na Reuel wey Ibnijah born, bi en grand-papa.

9Na 956 family kom back from Benjamin tribe and dem rite dia names for di rekord book. All of dem na leader for dia family.

10Di priests wey kom back to Jerusalem na: Jedaya, Jehoiarib, Jakin,

11and Zabud wey bi di leader for God Temple. Na Hilkaya wey Meshullam born bi en papa. Zadok wey bi Meraiot pikin, na-im bi Meshullam papa. Meraiot na Ahitub pikin.

12E still get Adaya wey Pashhur pikin Jeroham born and na Malkijah bi Pashhur papa. Adiel pikin, Priest Massai still dey and na Jahzerah bi en grand-papa. Na Meshullam born Jahzerah and na Meshillemit wey Imma born, bi Meshullam papa.

13Dem bi 1,760 priest wey kom back and dem bi leader for dia family. Dis men dey work well-well and na dem dey do God work for di temple.

14Levi pipol wey kom back to Jerusalem na: Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born wey kom from Merari tribe;

15Bakbakkar; Heresh, Galal and Matanaya wey Mikah born and dis Mikah, na Asaf grand-pikin wey Zikri born.

16E still get Shemaya pikin, Obadaya and na Galal wey Jedutun born, bi en grand-papa. Berakaya wey Asa born, na-im bi Jedutun papa. Na Elkanah bi Asa papa and na Netofat pipol land dem dey stay.

17Di temple guards wey kom back to Jerusalem na: Shallum, Akkub, Talmon, Ahiman and dia brodas. Na Shallum bi dia leader.

18Till today, na dia family dey guide di east side for di king gate. Before-before, na dem dey guide di gate wey dey for Levi pipol kamp.

19Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before.

20Finehas wey bi Eleazar pikin, na-im dey lead dem before and God dey with am.

21Zekaraya wey bi Meshelemaya pikin, don still bi guide before for Tabanako.

22All di men wey guide di gates na 212. Dem register dem akordin to where dem stay. Na King David and Samuel wey bi profet, put dem for dis pozishon.

23Na dem with dia shidren-shidren still dey guide di temple gate.

24Doz wey dey guide di gate dey for di four side wey face nort, sout, east and west.

25Dia family dey kom help and join dem guide for seven days.

26Di four main guide na from Levi tribe where dem for bi leaders. Na dem still dey kare for di store room and evritin wey dem keep for di temple.

27Dem dey sleep near di temple, bikos na dia work to guide and open di gate evritime.

28Some of dem dey keep di tins wey dem take dey woship God for di temple. Na dem dey bring and keep dem anytime wey dem use di tins finish.

29Na dem dey keep di holy tins, flour, wine, olive oil, incense and spices.

30But na di priests dey mix di spices.

31Mattitaya wey kom from Levi tribe, wey bi Shallum first pikin for Korah family, na-im dey bake di bread wey dem dey use for ofrin.

32Na Kohat family pipol dey bake di holy bread for di temple wen Sabat Day rish.

33Some family for Levi; dia work na to dey play music for di temple. Doz wey dey head dis family dey stay di rooms for di temple and dat na only wetin dem dey do, bikos dem fit koll dem to play, both for day and nite.

34Doz wey dem rite dia name down, dey head families for Levi tribe and dem dey stay for Jerusalem.

35Jeiel (wey bi Gibeon papa) dey stay for Gibeon town. En wife name na Maaka.

36En first pikin na Abdon, before Zur, Kish, Baal, Ner, Nadab,

37Gedor, Ahio, Zekaraya and Miklot

38wey bi Shimea papa. Dem dey stay Jerusalem near dia oda family.

39Na Ner bi Kish papa and na dis Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.

40Na Jonatan bi Merib-Baal papa and na Merib-Baal born Mikah.

41Mikah four sons na: Piton, Melek, Tarea and Ahaz.

42Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah three sons na: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa.

43Moza born Binea; Binea born Rafaaya wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.

44Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan. Na Azel pikin dem bi.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 9.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.