1 Chronicles 10pcm

1Filistia pipol fight with Israel pipol for Gilboa mountin. Dem kill many Israel pipol for der and di ones wey remain, run komot from der.

2But Filistia pipol porshu dem katch kon kill Saul three shidren: Jonatan, Abinadab and Malki-Shua.

3Di fight strong well-well for where Saul dey, so di enemies spear kon tosh and wound King Saul.

4Den Saul tell di boy wey karry en swod sey, “Make yu kill mi with yor swod, so dat all dis Filistia pipol wey nor know God nor go kom sofa mi.” But fear nor let di boy do am. So Saul take en own swod take kill ensef.

5Wen di boy si sey Saul don die, en too kon kill ensef.

6So Saul with en three shidren die togeda and nobody for en family dey to rule again.

7Wen Israel pipol wey dey Jezrel Valley hear sey di sojas don run and Saul with en shidren don die, dem kon run leave dia towns. Den Filistia pipol kon seize and start to stay di town.

8Di next day wen Filistia pipol kom gada tins from di pipol wey dem kill, dem kon si sey Saul with en three shidren don die for Gilboa mountin.

9Dem kut Saul head komot, remove en war klot kon send message go evriwhere for Filistia sey, make dem tell dia pipol and juju about di good news.

10Dem put en weapon for one of dia temple kon hang en head for dia juju wey dem dey koll Dagon, temple.

11Wen Jabesh pipol for Ramot hear wetin Filistia pipol do to Saul,

12doz wey get heart kon go take Saul and en shidren body go beri for Jabesh. Dem beri dem under one oak tree kon fast for seven days.

13Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am

14instead of God wey go guide am. So God kill-am kon make David wey bi Jesse pikin, king for Israel.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 10.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.