1Den all Israel pipol go meet David for Hebron kon tell am, “Wi bi yor own flesh and blood.
2Before-before, even wen Saul still bi awa king, yu karry us go fight and God wey bi yor God promise yu sey, yu go lead en pipol as dia king.”
3Wen di leaders for Israel meet David for Hebron, e make agriment with dem and dem anoint am as king for Israel, just as God promise dem thru Samuel.
4David and Israel pipol go attack Jerusalem. Dat time, dem dey koll Jerusalem, “Jebus”, bikos na Jebus pipol dey stay di land.
5Jebus pipol kon tell David sey e nor go fit enter di town, but David seize where God propaty dey for Zion, so dem kon dey koll di place, “David Town.”
6David sey, “Di first man wey go attack Jebus pipol, na-im go bi di sojas oga!” So Joab wey en mama na Zeruaya, first attack and kill dem, so e kon bi di sojas oga.
7David go stay for where dia betta propaty dey and na dis make dem dey koll am, David Town.
8David build di town again. E start from where big land dey for di east for di hill and Joab kon build di remainin side.
9David kon dey strong evriday, bikos di Oga God dey with am.
10Dis na David strong sojas wey help and make en kingdom stand for Israel.
11Dia names na: Jeshobeam wey kom from Hakmon tribe and naim dey head di ofisas. E kill three hundred men with en spear for only one war.
12Di next one na Dodo pikin, Eleazar wey kom from Ahohi tribe.
13E follow David fight Filistia pipol for Pass Dammim. E dey one side for di field wey barley full, even wen Israel pipol bigin run,
14en and en men dey di field centre kon fight Filistia pipol and God make dem win.
15One day, three of en strong sojas among di thirty kon go one rock where David dey stay near Adullam Kave, while some Filistia pipol dey Refah Valley.
16For dat time, David dey one hill wey dem guide well-well and some Filistia pipol dey for Betlehem.
17David dey hongry for wota so e kon sey, “I wish pesin fit go draw wota kon give mi from di well wey dey for Betlehem gate, so dat I go drink!”
18Di three strong sojas kon force diasef pass Filistia pipol kamp, draw wota from di well kon give David. But e nor gri drink am, instead, e pour am for groun as ofrin to God
19kon sey, “I nor fit drink dis wota, bikos e go bi like sey I dey drink dis men wey risk dia life, blood!” So e nor drink am. So dis na wetin di three strong sojas do.
20Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas.
21Na-im popula pass among “Di Three” and e kon bi dia leader, even doh e nor dey join di three.
22Jehoiada pikin Benaya wey kom from Kabzeel, na anoda strong soja. E still do many big tins kon kill two strong men for Moab. One day, e enter one pit go kill lion.
23E kill one Egypt man wey hold big spear for hand and tall rish seven and half fit. Benaya attack di man, kollect en spear kon kill-am.
24Dis na di strong tin wey Benaya do and e dey among, “Di Thirty.”
25Among di thirty, naim popula pass, but dem nor know am rish di three strong sojas. David kon make am di bodyguards oga.
26Di oda sojas wey do well na: Asahel wey bi Joab broda; Elhanan wey bi Dodo pikin wey kom from Betlehem;
27Shammot wey kom from Harod; Helez wey kom from Pelon;
28Ikkesh pikin, Ira wey kom from Tekoa; Abiezer wey kom from Anatot;
29Sibbekai wey kom from Hushah; Ilai wey kom from Ahohi;
30Maharai wey kom from Netofat; Baanah pikin, Heled wey kom from Netofat;
31Ribai pikin, Itai wey kom from Gibeah for Benjamin aria; Benaya wey kom from Piraton;
32Hurai wey kom from Gaash Valley; Abiel wey kom from Arbat;
33Azmavet wey kom from Bahurim; Eliahba wey kom from Shaalbon,
34Hashem wey Gizon born; Shagee pikin, Jonatan wey kom from Harar;
35Sakar pikin, Ahiam wey kom from Harar; Elifal wey Ur born;
36Hefa wey kom from Mekera; Ahijah wey kom from Pelon;
37Hezro wey kom from Karmel; Naarai wey kom from Ezbai;
38Joel wey bi Natan broda; Mibhar wey Hagri born;
39Zelek wey kom from Ammon; Naharai wey kom from Beerot. Na dis Naharai dey hold Zeruaya pikin, Joab swod.
40Ira with Gareb wey kom from Jattir;
41Uriaya wey kom from Hit; Zabad wey Ahlai born.
42Shiza pikin, Adina wey kom from Reuben tribe and di thirty sojas;
43Hanan wey Maaka born; Joshafat wey kom from Mitnite;
44Uzzia wey kom from Ashterah; Shama and Jeiel, Hotam shidren wey kom from Aroer tribe;
45Jediael wey Shimri, en broda Joha wey kom from Tiz born;
46Eliel wey kom from Mahavah; Jeribai and Joshavaya wey bi Elnaam shidren; Itmah wey kom from Moab tribe.
47Den Eliel, Obed and Jaasiel wey kom from Mezoba.