1Benjamin first son na Bela, sekond to Ashbel, before Ahara,
2Nohah and Rafa.
3Bela shidren-shidren na: Addar, Gera, Abihud,
4Abishua, Naaman, Ahoah,
5Gera, Shefufan and Huram.
6Dis na Ehud shidren-shidren. Dem bi di head for dia family and na Gibeah dem dey stay, but dem force dem go stay for Manahat.
7Ehud shidren na Naaman, Ahijah and Gera. Gera, wey bi Uzza and Ahihud papa, na-im lead dem for di journey.
8Afta Shaharaim porshu en too wifes, Hushim and Baara, e still born shidren wen e dey Moab land.
9E marry Hodesh wey born seven sons for am and dia names na: Jobab, Zibia, Mesha, Malkam,
10Jeuz, Sakia and Mirmah. All en shidren na leaders for dia family.
11Hushim still born two sons for am: Abitub and Elpaal.
12Elpaal born three sons: Eber, Misham and Shemed. Na Shemed build Ono and Lod town with all di village wey dey near am.
13Beraya and Shema na leaders for dia family and dem go stay for Aijalon kon porshu doz wey dey stay for Gat town komot.
14Beraya shidren na: Ahio, Shashak, Jerimot,
15Zebadaya, Arad, Eder,
16Mikael, Ishpah and Joha.
17Elpaal shidren na: Zebadaya, Meshullam, Hizki, Heba,
18Ishmerai, Izlaya and Jobab.
19Shimei shidren na: Jakim, Zikri, Zabdi,
20Elienai, Zilletai, Eliel,
21Adaya, Beraaya and Shimrat.
22Shashak shidren na: Ishpan, Eber, Eliel,
23Abdon, Zikri, Hanan,
24Hananaya, Elam, Antotijah,
25Ifdeaya and Penuel.
26Jeroham shidren na: Shamsheraya, Sheharaya, Atalaya
27Jaareshaya, Elijah and Zikri.
28All dis na di leaders for di family with dia shidren-shidren for Jerusalem just as dem rekord am.
29Na Jeiel build Gibeon town. En wife na Maaka
30and en first pikin name na Abdon, sekond to Zur, before Kish, Baal, Ner, Nadab,
31Gedor, Ahio, Zeka
32and Miklot wey bi Shimea papa. All dis family stay for Jerusalem near dia oda family pipol.
33Na Ner bi Kish papa and na Kish born King Saul. Saul born four sons: Jonatan, Malki-Shua, Abinadab and Eshbaal.
34Na Jonatan bi Meribbaal papa and Merib-Baal born Mikah.
35Mikah born four sons: Piton, Melek, Tarea and Ahaz.
36Ahaz na Jehoaddah papa and Jehoaddah born three sons: Alemet, Azmavet and Zimri. Na Zimri bi Moza papa.
37Na Moza born Binea, Binea born Rafah wey bi Eleasah papa and na Eleasah born Azel.
38Azel born six sons: Azrikam, Bokeru, Ishmael, Shearaya, Obadaya and Hanan.
39Azel broda, Eshek born three sons: Ulam, Jeush and Elifelet.
40Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi. Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.