1 Chronicles 7pcm

1Issakar four sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.

2Tola six sons na: Uzzi, Refaaya, Jeriel, Jahmai, Ibsam and Shemuel. Dem bi popula sojas and na dem dey head each family. For di time wen David bi king, di wariors for di family na 22,600.

3Uzzi born Izrahaya Izrahaya kon born Mikael, Obadaya, Joel and Isshaya and all of dem dey head dia family.

4Dem get many wifes and shidren and dem still get 36,000 wariors.

5All di wariors wey dem rekord for Issakar family na 87,000.

6Benjamin born three sons: Bela, Beka and Jediael.

7Bela kon born five sons: Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimot and Iri.

8Beka born nine sons: Zemirah, Joash, Elieza, Elioenai, Omri, Jerimot, Abijah, Anatot and Alemet.

9All of dem na leader for di family. Na 20,200 wariors dem rekord for di family.

10Jediael born one pikin wey dem dey koll Bilhan. Bilhan born seven sons: Jeush, Benjamin, Ehud, Kenaana, Zetan, Tarshish and Ahishahar.

11Dem dey head dia family. Na 17,200 wariors dey ready for war for dis family.

12Ir sons na Shuppim and Huppim. Na Aher born Hushim.

13Naftali born four sons: Jahziel, Guni, Jeza and Shallum. Dem bi Bilhah shidren.

14Manasseh girl-friend for Aramean born two sons for am and dem bi: Asriel and Makir. Na Makir born Gilead.

15Makir marry wife for Huppim and Shuppim. (En sista name na Maaka.) Zelofehad na Manasseh sekond son and na only girl shidren e born.

16Maaka wey bi Makir wife, born two boys: Peresh and Sheresh. Peresh sons na: Ulam and Rekem.

17Ulam pikin na Bedan. Ramot wey Makir born, na en shidren-shidren bi dis and na Manasseh bi Gilead grand-grand papa.

18Ramot sista, Hammoleket born three sons: Ishhod, Abiezer and Mahlah.

19Shemida sons na: Ahian, Shekem, Likhi and Aniam.

20Efraim shidren-shidren na: Shutela, Bered, Tahat, Eleada, Tahat and

21Zabad Shutela. (Afta Shutela, Efraim still born Ezer and Elead wey dem kill wen dem go tif animal for Gat pipol land.)

22Efraim wey bi dia papa kry for dem well-well and en brodas kon dey sorry for am.

23E sleep with en wife again and e kon born and dem koll di pikin Beraya, bikos di family don face trobol well-well.

24Efraim born one girl and en name na Sheerah. Na en build Uppa and Lowa Bet-Horon and Uzzen Sheerah towns.

25Efraim still born one son, Refah. Refah shidren-shidren na: Reshef, Telah, Tahan,

26Ladan, Ammihud, Elishama,

27Nun and Joshua.

28Dia propaty and lands na Bethel and di towns wey dey near am, go rish Naaran for di east and Geza for di west. Dem still stay for Shekem and Ayyah and all di towns wey near dem.

29Na Manasseh shidren-shidren dey kontrol Bet-Shean, Taanak, Megiddo, Dor and di oda towns wey dey near dem. Josef wey bi Jakob pikin, na en shidren-shidren stay all dis towns.

30Na Asher shidren-shidren bi dis: e born four sons: Imnah, Ishvah, Ishvi and Beraya with one dota wey en name na Serah.

31Beraya born two sons: Heba and Malkiel. Na Malkiel bi Birzait papa.

32Heba born three sons: Jaflet, Shoma and Hotam with one dota, Shua.

33Jaflet still born three sons: Pasak, Bimhal and Ashvat.

34En broda Shema sons na: Ahi, Rohgah, Hubbah and Aram: Rohgah, Hubbah and Aram.

35While dia last broda, Helem born four sons: Zofah, Imna, Shelesh and Amal.

36Zofah shidren-shidren na: Suah, Harnefa, Shual, Beri, Imrah,

37Beza, Hod, Shamma, Shilshah, Itran and Bera.

38Jeta shidren-shidren na: Jefunneh, Pispa and Ara.

39While Ulla shidren-shidren na: Arah, Hanniel and Rizia.

40All dis pipol na Asher shidren-shidren. Dem dey head dia family and dem bi popula sojas. Asher wariors na 26,000 just as dem rekord am.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 7.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.