1Levi three shidren na: Gershon, Kohat and Merari.
2Kohat born four shidren: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
3Amram two sons na: Aaron and Moses and en girl pikin name na Miriam. Aaron get four sons wey bi: Nadab, Abihu, Eleazar and Itama.
4Eleazar bi Finehas papa, Finehas bi Abishua papa,
5Abishua bi Bukki papa, Bukki bi Uzzi papa,
6Uzzi bi Zerahaya papa, Uzzi bi Meraiot papa,
7Meraiot bi papa, Amaraya bi Ahitub papa, Ahitub bi Zadok papa,
8Zadok bi Ahimaaz papa, Ahimaaz bi Zabud papa,
9Zabud kon born Johanan,
10(Na dis Zabud bi di priest for di temple wey King Solomon build for Jerusalem),
11Zabud bi Amaraya papa, Amaraya bi Ahitub papa,
12Ahitub bi Zadok papa, Zadok bi Shallum papa,
13Shallum bi Hilkaya papa, Hilkaya bi Zabud papa,
14Zabud bi Seraya papa, Seraya bi Jehozadak papa.
15King Nebukadnezzar kon karry Jehozadak with Judah and Jerusalem pipol go Babilon as slave.
16Levi born three sons: Gershom, Kohat and Merari.
17All of dem still born sons too. Na Gershom born Libni and Shimei:
18Kohat kon born Amram, Izhar, Hebron and Uzziel;
19Merari na Mahli and Mushi papa.
20Gershom shidren-shidren na: Libni, Jahat, Zimma,
21Joah, Iddo, Zera and Jeaterai.
22Kohat shidren-shidren na: Amminadab, Korah, Assir,
23Elkanah, Ebiasaf, Assir,
24Tahat, Uriel, Uzzaya and Shaul.
25Elkanah shidren-shidren na Amasai, Ahimot,
26Elkanah, Zofai, Nahat,
27Eliab, Jeroham, Elkanah and Samuel.
28Samuel sons na: Joel (na-im bi senior), sekond to Abijah.
29Merari shidren-shidren na: Mahli, Libni, Shimei, Uzza,
30Shimea, Haggiaya and Asaya.
31Na di men wey David put for di temple make dem dey play music afta dem don karry di Kovenant Box go der, bi dis.
32Na dem dey do all di work for Tabanako, before King Solomon build temple for Jerusalem.
33Doz wey serve along with di sons na: From Kohat pipol: Heman wey Samuel pikin Joel born and naim dey lead di first kwaya.
34Samuel na Elkanah pikin. Jeroham wey Eliel born, na-im bi Elkanah papa. Eliel na Toah pikin.
35Na Zuf born Toah and na Elkanah bi Zuf papa. Elkanah na Mahat pikin and na Amasai born Mahat.
36Amasai na Elkanah pikin. Elkanah na Joel pikin and na Zabud born Joel. Zabud na Zefanaya pikin.
37Tahat wey Assir born, na-im bi Zefanaya papa.
38Assir na Ebiasaf pikin and na Korah born Ebiasaf. Korah na Izhar pikin. Na Kohat born Izhar. Levi wey Israel born, na-im bi Kohat papa.
39Na Asaf dey lead di sekond kwaya and na Berekaya bi en papa. Berekaya na Shimea pikin.
40Mikael wey Baaseaya born, na-im bi Shimea papa. Baaseaya na Malkijah pikin
41and na Etni born Malkijah. Etni na Zera pikin and na Adaya wey
42Etan born bi Zera papa. Etan na Zimma pikin and na Shimei born Zimma.
43Shimei na Jahat pikin. Na Gershom born Jahat. Gershom na Levi pikin.
44Levi pipol wey serve near dem na Etan wey kom from Merari family. Etan na Kishi pikin and Kishi na Abdi pikin. Abdi na Malluk pikin,
45and na Hashabaya bi Malluk papa. Hashabaya na Amazaya pikin and na Hilkaya bi Amazaya papa.
46Amzi wey Bani born, na-im bi Hilkaya papa. Bani na Shema pikin,
47while Shema na Mahli pikin. Na Mushi born Mahli and na Merari bi Mushi papa. Merari na Levi pikin.
48Di remainin pipol for Levi wey dem give work for God house, na dem bi dis.
49Na Aaron and en shidren-shidren dey offa sakrifice for God altar. Na dem dey kare for di holy place and for all di sakrifice wey go make God forgive Israel pipol dia sins. Dem do all dis tins, just as Moses kommand dem.
50Aaron shidren-shidren na: Eleazar wey born Finehas and na Finehas bi Abishua papa.
51Abishua na Bukki papa. Na dis Bukki born Uzzi wey bi Zerahaya papa.
52Na Zerahaya born Meraiot wey bi Amaraya papa and Amaraya born Ahitub.
53Na Ahitub bi Zadok and Ahimaaz papa.
54Aaron wey kom from Kohat family with en shidren-shidren, na where e dey stay bi dis. Di first share wey dem give Levi pipol for di land, na dem take am.
55Na dem get Hebron near Judah and all di land wey dey near am.
56Di lands and village wey dey di town, dem gi-am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.
57Dis na di towns wey dem give Aaron shidren-shidren: Hebron, Libnah, Jattir, Eshtemoa,
58Hilez, Debir,
59Ashan and Bet-Shemesh with all dia land.
60Di towns and lands wey dem give dem for Benjamin aria na: Gibeah, Alemet and Anatot. So all di towns na thirteen.
61Dem give di rest pipol for Kohat shidren-shidren ten towns, wey bi half of Manasseh tribe.
62Dem give Gershom shidren-shidren, thirteen towns for Issakar, Asher, Naftali and East Manasseh wey dey for Bashan aria.
63Na so too, dem still give all Merari family twelf towns for Reuben, Gad, and Zebulun aria.
64Na like dis too, Israel pipol take give Levi pipol dia towns and lands.
65Di towns for Judah, Simeon and Benjamin aria wey dem rite down before, dem still give dem to Levi pipol.
66Some among di family, dem give dem Kohat towns and dia lands wey dey Efraim aria.
67Dem still give dem Shekem towns and some lands wey dey for Efraim hill kountry with Geza and dia lands too.
68Dem still give Levi pipol Jokmeam, Bet-Horon,
69Aijalon and Gat-Rimmon towns with all dia lands.
70For West Manasseh aria, dem give dem Aner and Bileam towns with all dia land.
71Dis na di land and field wey dem give Gershom tribe: For East Manasseh aria, dem give dem: Golan for Bashan and Ashtarot.
72For Issakar aria, dem give dem: Kedesh, Daberat,
73Ramot and Anem.
74For Asher aria, dem give dem: Mashal, Abdon,
75Hukok and Rehob.
76For Naftali aria, dem give dem: Kedesh for Galilee, Hammon and Kiriataim.
77Di remainin family wey dey Merari tribe, na di land wey dem give dem bi dis: For Zebulun aria, dem give dem: Rimmono and Tabor.
78For Reuben aria wey dey di east side for Jordan River afta Jeriko, dem give dem: Beza, Jahza,
79Kedemot and Mefaat.
80For Gad aria, dem give dem: Ramot for Gilead, Mahanaim,
81Heshbon and Jazer.