1 Chronicles 15pcm

1David build many house for ensef for en own town. E still make one place for God Kovenant Box.

2David kon sey, “Na only Levi pipol go karry di Kovenant Box, bikos na dem God choose to karry di box and serve am forever.”

3So David gada Israel pipol go Jerusalem make dem go bring di Kovenant Box kom di place wey e make for am.

4So e sey make dem koll Levi pipol and Aaron shidren-shidren kom.

5From Kohat family: dem koll 120 pipol and na Uriel dey lead dem.

6From Merari family: dem koll 220 pipol and na Asaya dey lead dem.

7From Gershom family: dem koll 130 pipol and na Joel dey lead dem.

8From Elizafan family: dem koll 200 pipol and na Shemaya dey lead dem.

9From Hebron family: dem koll 80 pipol and na Eliel dey lead dem

10and from Uzziel family: dem koll 112 pipol and na Amminadab dey lead dem.

11David koll Priest Zadok and Priest Abiatar with six pipol form Levi tribe and dem bi: Uriel, Asaya, Joel, Shemaya, Eliel and Amminadab.

12E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.

13God ponish us, bikos una nor dey der to karry am for di first time and wi nor woship am as wi suppose to.”

14Den Levi pipol and di priest kon klean demsef, so dat dem go fit karry Israel God Kovenant Box.

15Levi pipol karry di box for pole kon put am for dia shoulder, just as God kommand thru Moses, en savant.

16David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”

17So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.

18Di pipol wey dem choose to assist dem na: Zekaraya, Jaaziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Benaya Maaseaya, Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya and Obed-Edom and Jeiel wey dey guide di gate.

19Doz wey dey sing na Heman, Asaf, Etan and na dem dey play di bronze cymbals;

20Zekaraya, Aziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Maaseaya and Benaya dey play di harps.

21Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya, Obed-Edom, Jeiel and Azazaya dey play di lyres.

22Bikos Kenanaya sabi play music well-well, dem kon make am dia leader.

23Dem choose Berakaya and Elkanah make dem dey guide di Kovenant Box.

24Doz wey dem choose to blow trumpet for di Kovenant Box front na: Shebanaya, Joshafat, Netanel, Amasai, Zekaraya, Benaya and Elieza and all of dem na priests. Dem still choose Obed-Edom and Jehaya make dem dey guide di box too.

25So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.

26Dem sakrifice seven bull and seven ram, bikos God dey help di Levi pipol wey karry di Kovenant Box.

27Doz wey dey play music, with Shenanaya wey bi dia leader and Levi pipol wey karry di box, wear one robe wey dem make with fine linen. David too dress like priest and e wear robe too.

28So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.

29As dem bring di box enter di town, Saul dota, Mikal look thru window kon si David en husband dey dance anyhow, so e kon dey vex for am.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 15.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.