1 Chronicles 16pcm

1Dem karry di Kovenant Box go put for di tent wey David make for am. Den dem do sakrifice kon woship God.

2Afta David don give di sakrifice finish, e kon bless di pipol with God name and

3all of dem kon chop beleful. E give bread, meat wey dem roast and rice to each pesin for Israel.

4David tell some Levi pipol sey, make dem lead di pipol as dem dey woship for di Kovenant Box front kon dey sing and praiz di Oga wey bi Israel pipol God.

5Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.

6Na Priest Benaya and Priest Jahaziel dey blow di trumpet for di Kovenant Box front.

7Dat day, David first sey make Asaf with all Levi pipol sing dis song take tank God:

8“Make una tank and koll God name! Make una let di whole world know di tins wey E do!

9Make una sing dey praiz God! Make una tok about di wonderful tins wey E dey do!

10Make una boast about en name wey dey holy! Doz wey dey serve am, make una happy!

11Make una go meet God and E go help una! Make una always dey woship am!

12Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,

13bikos na una bi Israel shidren-shidren; God savant; pipol wey kom from Jakob wey God don choose as en own!

14Na-im bi di Oga awa God! Na-im dey judge di whole eart.

15Make una nor forget wetin dey God kovenant; en kovenant wey go last forever,

16just as E promise Abraham and Isaak.

17God give en kovenant to Jakob and na kovenant wey go last forever.

18E sey, ‘I go give yu Kanaan land and e go bi yor own.’

19Dat time, God pipol nor many and dem bi strenjas for di land.

20Dem dey waka from kountry to kountry and from town to town.

21God nor let anybody opress dem; instead, E ponish kings bikos of dem kon sey:

22‘Make una nor tosh di pipol wey I choose or trobol my profets.’

23Make evribody for di eart sing to God! Make una always dey tok about en goodness and how E take dey save pesin.

24Make una tell di world about en glory and di big-big tins wey E dey do.

25Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.

26Di gods for oda towns nor mean anytin, but na God make di heavens.

27Na-im get glory and majesty! Na-im dey give us pawa and joy.

28Make evribody praiz God! Make una praiz God for en glory and how E big rish.

29Make una give God di praiz wey bi en own! Make una bring ofrin kom en present! Make una dey holy kon woship God!

30Make evritin wey dey dis world fear God! God don make di world stand and nor-tin go fit move or break am.

31Make di heavens and eart dey happy! Make una tell di whole world sey, na God bi king.

32Make di sea and evritin wey dey inside, shaut! Make di grass and evritin wey dey inside dem bigin dance!

33Den make all di trees for bush shaut with joy for God, bikos E dey kom judge di world.

34Make una tank God, bikos E dey good, en love go dey forever.

35Make una pray kon sey, ‘Awa Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us kon save us from dis nashons! Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’

36Make di Oga wey bi Israel God get all di praiz from naw and forever.” Den all di pipol ansa, “Amen! Wi go praiz di Oga awa God!”

37King David sey make Asaf and some Levi pipol dey lead di pipol as dem dey woship God for di tent where di Kovenant Box dey and na der dem go for dey do dia work evriday.

38Dem still choose Obed-Edom wey bi Jedutun pikin and 68 oda men. Na Hosah and Obed-Edom dey guide di gate.

39Na Priest Zadok and di oda priests dey serve for God house for Gibeon.

40Evry morning and evening, dem dey offa burnt sakrifice for di altar, just as dem rite am for God Law Book.

41Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.”

42Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.

43Den evribody go back to en house and David go en house too go bless en family.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 16.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.