1 Chronicles 14pcm

1King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.

2David know sey na God make am king for Israel and E dey prosper en kingdom and pipol.

3David marry plenty wifes for Jerusalem and e born many shidren.

4Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon,

5Ibhar, Elishua, Elpelet,

6Nogah, Nefeg, Jafia,

7Elishamah, Beeliada and Elifelet.

8Wen Filistia pipol hear sey dem don make David king for Israel, dia sojas gada won kon go fight am. But David hear dia plan, so en and en men kon mash go meet dem.

9Filistia pipol go skata evriwhere for Refah Valley.

10So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?” God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”

11So David attack and win dem for Baal-Perazim. David kon sey, “My Oga God don use mi take distroy my enemies like wota wey dey rush fit force.” So E kon koll di place, “Baal-Perazim.”

12Wen Filistia pipol dey run, dem leave dia juju, so David orda en pipol make dem burn dem trowey.

13E nor too tey before Filistia pipol go skata di valley again.

14Den David ask God again and E sey, “Nor attack dem from dis side, but go pass thru where di Balsam trees dey.

15And wen yu hear pipol dey mash on-top di trees, make yu attack dem bikos, I go mash go yor front go distroy Filistia sojas.”

16David kon do as God kommand, so e drive Filistia pipol from Gibeon pass Geza.

17David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 14.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.