1 Chronicles 13pcm

1King David koll and tok to di ofisas with

2Israel pipol sey, “If una and di Oga awa God go like am, den e betta make wi send message go meet awa remainin brodas, priests and Levi pipol for dia towns sey make dem gada kom

3follow us go karry God Kovenant Box, wey dem abandon thru-out di time wey Saul bi king.”

4Wetin David tok, kon make di pipol dey happy.

5So David gada Israel pipol from Shihor River for Egypt go rish Hamat, so dat dem go-go bring God Kovenant Box from Kiriat-Jearim.

6David and all di pipol kon go Baalah town (wey bi Kiriat-Jearim), for Judah go bring God Kovenant Box wey dey on-top di creature wey get feada. Na God name dem dey koll di box.

7Dem bring di Kovenant box kom out from Abinadab house, put am for one new truck and na Uzza and Ahio dey guide am.

8David with all di pipol kon dey dance with dia heart to honor God. Dem sing dey play instrument, harp, drums, cymbals and trumpets.

9Wen dem rish where dem for dey separate wheat for Kidon, di truck wey dem put di Kovenant Box kon dey shake like sey e won fall, so Uzza kon hold di box make e for nor fall.

10At wons, God vex kon kill Uzza, bikos e tosh di box.

11David vex well-well, bikos God kill Uzza, so e koll di place Perez Uzza and na-im dem dey koll am till today.

12Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?”

13So David nor karry am go Jerusalem again, instead, e karry am go Obed-Edom wey kom from Gat, house.

14God Kovenant Box dey Obed-Edom house for three monts, so God bless Obed-Edom family and evritin wey dem get.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 13.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.