1Dis na di message wey God give Zefanaya for di time wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah. Kushi wey bi Gedalaya pikin, naim bi Zefanaya papa and na Amaraya wey bi Hezekaya pikin, born Gedalaya.
2God sey, “I go swip evritin komot from dis eart.
3I go swip both pipol and animals. I go distroy di birds for di sky and di fish for sea. I go turn wiked pipol place to where dem dey trowey dirty put kon distroy human being komot from dis eart.
4Na with my hand I go take skata Judah, Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju wey dem dey woship. I go distroy all dia wiked priests and nobody go remember dem again,
5bikos dem klimb on-top dia house go bow for di sun, moon and stars. Dem dey klaim sey dem dey follow God, but dem still dey woship Molek juju.
6I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”
7So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.
8God sey, “For judgement day, I go ponish Judah leaders, all dia prince and all doz wey dey sin.
9For dat day, I go ponish di pipol wey dey serve juju and wey turn dia oga house to where dem dey kworel and play pipol wayo.”
10God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.
11All of una wey dey stay near di market, make una kry with pain, bikos I go distroy all doz wey dey sell and buy.
12I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.
13So, pipol go tif and karry dia propaty kon skata dia house. Dem go build new house, but dem nor go ever stay inside. Dem go plant vineyard, but dem nor go ever drink from di wine.
14Di day wey God go make evribody fear, don near. E go kom kwik-kwik and nobody go like am, bikos for dat day, even strong men go kry.
15Dat day, God go vex well-well and di wahala and pain nor go eazy at-all. Dat day go bi to skata and distroy; day wen evriwhere go dark well-well. Yes! Dat day go kom with tick kloud and darkness.
16For dat day, trumpet go dey blow and war go dey evriwhere. Evriwhere for di town go dey shake; even di walls wey strong well-well, go fall skata!
17Bikos una don sin against God, I go make una waka dey find road like blind man. Dem go pour una blood for san-san and una body go rotin for groun.”
18Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.