Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Habakkuk 3

:
Nigerian - pcm
1 Dis na di prayer wey Profet Habakkuk pray:
2 My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.
3 God dey kom from Teman; God wey dey holy dey kom from Mount Paran. En glory kover di heavens and na en praiz full di eart.
4 E dey shine like sun as E dey kom and lite dey shine from en hand, where en pawa der.
5 E send diziz go for en front kon kommand deat follow am for back.
6 Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.
7 I si Kushan pipol dey fear and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.
8 My God, na di sea make Yu dey vex? Yu really dey vex for di river dem? No! Yu dey kom with yor shariot kon save us!
9 Yu dey ready to use yor bow kon shot yor arrow. Yor lite for heaven dey divide di eart into two.
10 Mountins dey fear as dem si Yu; rain dey fall from di kloud and waves for sea dey raiz and make nois bikos of Yu.
11 As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.
12 Yu vex mash pass di eart and as Yu dey vex, Yu kon skata all di nashons.
13 Yu go save yor pipol and di king wey Yu choose. Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol kon distroy doz wey dey follow am.
14 Wen en sojas gada dey kom like strong breeze to kom skata and opress us, Yu kill dem with yor arrow.
15 Yu mash di sea with yor horse and di mighty river kon dey foam.
16 I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.
17 Even doh di fig and olive tree nor get fruit naw and di grape nor gri grow for di vine or sey di land produce korn and all di animals don die,
18 I go still dey happy and sing for joy, bikos na Oga God dey guide mi.
19 God wey get pawa dey give mi strent. E make mi stand strong for groun like deer kon keep mi save on-top di mountin. (For di kwayamasta: Make dem sing dis song with instrument like, jita.)