Song of Solomon 7pcm

1Fine woman! Make yu si as yor leg fine for inside sandal. Yor lap round like gold wey betta goldsmit make.

2Yor pompu round like cup wey full with wine wey dem mix. Yor belle bi like many korn seed wey lily gada round.

3Yor two breast bi like gazelle or deer wey bi twins.

4Yor neck fine just like ivory towa and yor eyes bi like Heshbon Pool wey dey shine near Bat-Rabbim Gate. Yor nose fine like Lebanon towa wey face Damaskus.

5Yor head fine like Mount Karmel. Yor hair dey shine like design wey dey di king garment. Di wey e fine, dey sopraiz di king well-well.

6So my love, make yu si as yu fine rish! Yes! Yu too fine; si as love make yu komplete well-well.

7Yu slim like palm tree and yor breast bi like palm fruit.

8I sey, “I go klimb di tree kon plok en fruit. To mi, yor breast bi like grape and di smell from yor nose, dey scent like apple.”

9So make yor mout taste like di wine wey good pass, wey go flow small-small enter awa lips wen wi dey sleep togeda.

10I bilong to my love and e don take mi as en own.

11My love, kom dis nite make wi go sleep on-top di flowers for di field.

12Make wi wake-up for early morning go di vineyard, so dat wi go si weda di grape vine don get new leaf and if di leafs don open or if di pomegranate fruit don dey grow. And na for der I go for give yu my love.

13Di mandrake fruit and di fruit wey fine pass, dey give us sweet smell. My darlin, difren kind of good tins dey awa door-mot and I don keep both old and new wons for yu.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Song of Solomon 7.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.