1Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow.
2So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.”
3Bikos E go save yu from evry trap kon protet yu from doz diziz wey dey kill pesin.
4E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.
5So, make una nor fear di wahala for nite or di arrow wey dey fly for day time.
6Make una nor fear diziz wey dey kom for darkness or trobol wey dey kom for aftanoon.
7Aldo one tazon pipol go fall for una side and ten tazon dey die around una, but di enemies and dia evil nor go fit tosh una.
8Una go si am with una own eyes! Yes, una go si as God dey ponish wiked pipol.
9If una make God di place where una dey hide put; if una make di Most High God where una dey stay,
10no evil go fit tosh una and no wahala or diziz go kom near where una dey.
11Bikos E go kommand en angels make dem protet una for evritin wey una dey do.
12Dem go use dia hand karry una up, so dat una nor go even kick or fall on-top stone.
13Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg!
14God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name.
15Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.
16I go bless dem with long life and give dem my salvashon.”