Psalms 90pcm

1My Oga God, from generashon to generashon na Yu dey protet us!

2Yu bi God wey nor dey die! Even before Yu kreate di mountins and di whole world, Yu don dey.

3Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey, “Make una go back to where I for kreate una!”

4To Yu, one tazon years bi like one day or like some hours for nite.

5Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish. Dem bi like grass wey grow for morning.

6For morning, dem dey grow and shine, but for evening, dem go dry kon die.

7Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.

8Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.

9Yes! As wi dey alive, wi dey si as Yu dey vex and awa years dey kwik-kwik end.

10Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.

11So na who go fit know as Yu dey vex rish? Yor vexnashon strong well-well and e dey make us fear Yu.

12So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.

13My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!

14Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail, so dat till wi die, wi go always dey sing with joy.

15Make Yu replace awa former sofa with happiness and awa bad years with good tins!

16Make Yu let wi yor savants si yor works again kon allow awa shidren si yor glory.

17Make di Oga awa God show us en favor, den evritin wey wi dey do, go prosper. Yes! Make Yu allow evritin wey wi dey do, prosper!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 90.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.