1My God, make Yu listin to mi as I dey komplain! Make Yu protet my life from all di wiked attack wey di enemies dey plan.
2Make Yu hide mi from wiked men plan; di pipol wey dey do evil and bad tins.
3Dem don sharp dia tongue like swod kon ready to shot dia betta words wey bi like arrows.
4From where wiked pipol hide put, dem dey shot innocent pipol kon kwik-kwik attack dem and dis wiked pipol, nor dey fear.
5Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”
6As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.
7But God go shot dem; na wons en arrows go wound dem and dem go fall.
8Na dia own bad word go kill dem. And anybody wey si dem, go shake en head kon sorry for dem.
9Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.
10Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.