Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 64

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu listin to mi as I dey komplain! Make Yu protet my life from all di wiked attack wey di enemies dey plan.
2 Make Yu hide mi from wiked men plan; di pipol wey dey do evil and bad tins.
3 Dem don sharp dia tongue like swod kon ready to shot dia betta words wey bi like arrows.
4 From where wiked pipol hide put, dem dey shot innocent pipol kon kwik-kwik attack dem and dis wiked pipol, nor dey fear.
5 Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”
6 As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.
7 But God go shot dem; na wons en arrows go wound dem and dem go fall.
8 Na dia own bad word go kill dem. And anybody wey si dem, go shake en head kon sorry for dem.
9 Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.
10 Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.