Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 63

:
Nigerian - pcm
1 Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.
2 I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory.
3 Yor love wey nor dey fail betta pass life; so I go praiz Yu!
4 I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.
5 Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
6 and for nite, I nor dey fit sleep, bikos I dey tink about how Yu
7 help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow.
8 I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.
9 But distroshon go follow doz wey dey plan to distroy mi. Dem go die go where dead body dey.
10 Na swod go kill dem, den birds and oda animals go chop dia body.
11 But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.