1Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.
2I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory.
3Yor love wey nor dey fail betta pass life; so I go praiz Yu!
4I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.
5Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
6and for nite, I nor dey fit sleep, bikos I dey tink about how Yu
7help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow.
8I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.
9But distroshon go follow doz wey dey plan to distroy mi. Dem go die go where dead body dey.
10Na swod go kill dem, den birds and oda animals go chop dia body.
11But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.